Naomi Campbell don born her first pikin!

Naomi Campbell

Wia dis foto come from, Getty Images

Na baby girl!

Super model Naomi Campbell don welcome her first pikin, a bouncing baby girl.

Nami pikin legs for her hand

Wia dis foto come from, Naomi Campbell/ Instagram

For May 2017, Naomi bin tell tori pipo Evening Standard magazine say: "I dey tin about borning pikin all di time."

Di 50 years old super model announce di birth of her pikin for Instagram.

Inside di post she say: !One small beautiful blessing don choose me to be her mama, i dey so honoured to get dis gentle soul for my life words n dey to describe di lifelong bond wey I now share wit you my angel. No love pass dis one."

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Who bi Naomi Campbell?

Naomi Campbell bi one of di most popular supermodels for di world.

Di supermodel don walk runway for most popular designers. She don also appear for TV and act for inside movies.

She also dey popular for di romantic relationships wey she dey get.

No bi only rich businessmen she don dey associated wit, but her fellow ogbonge celebrities dey.

Dis date-date tori don cos make her fans dey wonder who Naomi Campbell don date and weda she still dey follow dem yarn.