APC say di gbege wey happun during presidential election for Rivers State na eye oppener
Dem say even inside di midst of heavy intimidation against Rivers APC, for election where dem no get candidates, APC supporters still tour out with well over 200,000 votes.
Tonye Cole wey speak for APC tok say if dem compare wetin APC get inside dis election of 2019, to di score of just 69,000 votes dem get for 2015 wit all di intimidation, e show say tins dey improve.
APCCopyright: APC
How Pitawa react wen INEC declare Buhari winner on Wednesday morning. #BBCNigeria2019
8 House of Reps. election results from River State wey INEC approve
Results for seven house of Reps and one senate wey don comot for Rivers state show say PDP naim win dem.
But di remaining 5 house of Reps and two senate seats Rivers East and Rivers West senatorial districts dey inconclusive.
Dis na according to National Assembly results wey INEC publish.
Dis na because results from four local goment dem, Ikwerre, Okrika, Ahoada West and Emohua dey cancelled and election no hold for two local goment - Akuku Toru and Bonny sake of violence and military invasion wey happen dia.
INEC never tok if dem go do any repeat elections for dis areas
Nigeria President-Elect, Muhammadu Buhari dey collect im Certificate of Return
Muhammadu Buhari dey collect im Certificate of Return as di tear rubber president of Nigeria from di kontri election office, INEC for Abuja.
According to Nigeria 2010 electoral act, di election office go within a period of seven days give Certificate of Return to di winner of election after dem declare di result.
President Muhammadu Buhari and Vice President Yemi Osinbajo na im follow collect and sign di Certificate of Return as winners of di 23 February, 2019 Presidential election.
Kano barber dey give free haircut to celebrate Buhari win
Oga Idris dey offer free barbing for im shop Soft Touch wey dey Kano to celebrate President Buhari victory.
BBCCopyright: BBC
Get Involved
Wetin Nigerians wan from Presido Buhari for di next four years?
Sani Ibrahim for Kano say im want Presido Buhari to take special interest on issues wey concern those wey dey physically challenged.
BBCCopyright: BBC
BreakingAtiku don reject election result, say im dey go court
Atiku TwitterCopyright: Atiku Twitter
Presidential candidate of di People's Democratic Party, oga Atiku Abubakar don reject di result of election wey INEC say na candidate of di APC, presido Muhammadu Buhari win.
Im tok say im neva see election wey bad like dis, and say im dey go court.
For statement wey im media team release on Wednesday, wey oga Atiku sign imsef, im say e dey clear say "magomago wey dem bin don plan, happun for many states wia dem announce result."
"Di one wey make eye water pass na say e no dey possible say states wey katakata dey happun go get pipo wey come out to vote than states wey dey peaceful.
"Di way dem use oppress voters for areas wey I get strong leg clear sotey shame catch me as Nigerian. How total voters for Akwa-Ibom, for instance, go dey 50% less than wetin dem be for 2015?" Im ask.
Im also mention states like Lagos, Akwa-Ibom, Rivers and odas, wia im party PDP strong, and say magomago happun but say authorities no do anything and even join hand sef.
"If to say I lose free and fair election, I for don call pesin wey win sharp-sharp, congratulate am, and even offer my services to help unite Nigeria like bridge between di North and di South."
Im come assure im supporters and Nigerians say togeda, "we no go allow democracy make e enta chains."
Live Reporting
By Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo
All dem times wey dem write be UK
Na here we go march break!
Na here we go march break ontop dis Nigeria 2019 Presidential election ogbonge live tori dem.
Before we go make we sama una some of di victory foto dem from across northern Nigeria.
How some Nigeria newspapers bin report Buhari victory on Wednesday
See how some Nigeria news papers bin report Buhari victory on Wednesday
2015 election beta pass 2019 - Nigeria Election Observer
Dis Election Observer for Bayelsa and Delta state no hold back evritin wen e observe.
Benjamin Bedford, Election Observer from Cleen Foundation say 2015 election beta pass 2019 own.
African, world leaders congratulobia to Buhari
APC say Rivers election gbege na eye opener
APC say di gbege wey happun during presidential election for Rivers State na eye oppener
Dem say even inside di midst of heavy intimidation against Rivers APC, for election where dem no get candidates, APC supporters still tour out with well over 200,000 votes.
Tonye Cole wey speak for APC tok say if dem compare wetin APC get inside dis election of 2019, to di score of just 69,000 votes dem get for 2015 wit all di intimidation, e show say tins dey improve.
How Pitawa react wen INEC declare Buhari winner on Wednesday morning. #BBCNigeria2019
Dis na di worst election in 30 years - Atiku
"Wen you compare di figures of di results of di election, you go see say di numbers no add up. Na for dis reason wey make I reject di result"
Dat na wetin Aiku Abubakar, di PDP candidate for im world press conferece.
"Inside my 30 years struggle for democracy dis na di worst election I don see."
Even military neva organize dis kain yeye election, na wetin Atiku tok say im tell Abdulsami Abukakar on Monday wen dem tok for phote
Foto of Buhari as im collect di certificate wey confam in #NextLevel
Victory dey sweet no be lie.
See foto of Buhari as im collect di certificate wey confam in #NextLevel
8 House of Reps. election results from River State wey INEC approve
Results for seven house of Reps and one senate wey don comot for Rivers state show say PDP naim win dem.
But di remaining 5 house of Reps and two senate seats Rivers East and Rivers West senatorial districts dey inconclusive.
Dis na according to National Assembly results wey INEC publish.
Dis na because results from four local goment dem, Ikwerre, Okrika, Ahoada West and Emohua dey cancelled and election no hold for two local goment - Akuku Toru and Bonny sake of violence and military invasion wey happen dia.
INEC never tok if dem go do any repeat elections for dis areas
Atiku Press Conference as e dey happun
Video content
Dis na fotos from Umar Musa Yar'Adua Conference centre wia PDP Presidential Candidate Atiku Abubakar dey address tori pipo for world press conference.
Di voting partern show say almost all Nigerians stand wit two candidates
Atiku wan break silence for di first since e lost election
Nigeria main opposition candidate Atiku Abubakar just announce say im go address world press conference live by 4pm on Wednesday.
Atiku wey don already reject di results say e go challenge am for court plan to di toko-tok wit tori pipo for Musa Yar'Adua Centre.
You fit find di tori here by dat time.
APC dey ask Nigerians to tell Buhari wetin im go focus dis 2nd term
Nigeria goment party APC dey ask pipo to tell dem wetin dem want President Muhammadu Buhari to pay more attention to, for im second tenure.
Di options include:
Nigeria President-Elect, Muhammadu Buhari dey collect im Certificate of Return
Muhammadu Buhari dey collect im Certificate of Return as di tear rubber president of Nigeria from di kontri election office, INEC for Abuja.
According to Nigeria 2010 electoral act, di election office go within a period of seven days give Certificate of Return to di winner of election after dem declare di result.
President Muhammadu Buhari and Vice President Yemi Osinbajo na im follow collect and sign di Certificate of Return as winners of di 23 February, 2019 Presidential election.
Open border" Lagos traders to Buhari victory
Congrats from Zimbabwe
Belly dey sweet dis Buhari supporter for Kano State
Mansur Abubakar
BBC Pidgin, Kano