Video caption: Coronavirus tips: How to self-isolate to prevent di spread of Covid-19Coronavirus tips: How to self-isolate to prevent di spread of Covid-19
We share 5 tips to epp anybodi wey need to, or dem don tell to self-isolate to prevent di spread of Covid-19.
Pipo dey wonder how dis event go take place wen Nigeria goment neva give green light on social gatherings of more than 50 pipo and interstate travel still dey banned.
Dis na wia we go march break ontop our live coverage today.
No forget to join us tomorrow again.
You fit scroll down for Thursday tori dem.
Remember, make you dey wash your hands. Covid-19 dey rea
East Africa roll out plan wey go helep di economy ontop Covid-19 palava
Finance ministers for East Africa don list measures dem go
use to take improve di economic impacts of coronavirus.
Di goment of Kenya, Uganda and Tanzania don all outline dia
spending and taxation plan for budget announcements wey suppose happen on di
same day.
Money wey goment for di three kontris don spend reach $52.6bn
(£41.7bn).
For Kenya, di goment don put $500m to spend on tourism,
manufacturing and agricultural sectors, wey dey affected by di measures dey cari out to stop spread of Covid-19.
To help pay for goment spending, Kenya’s Finance Minister
Ukur Yatani don propose new tax on companies wey dey provide digital services,
wey fit be controversial.
Uganda show plans to delay di payment of corporate and
income tax to relief di burden on companies and employees.
Tanzania Finance Minister Philip Mpango stress say di
government go maintain dia levels of spending but acknowledge say di pandemic
go reduce economic growth from 6.9% to 5.5%.
Children fit spread coronavirus if schools reopen?
BBCCopyright: BBC
How likely e dey for children to catch and even spread
coronavirus be frequent topic wen dem dey discuss whether to reopen schools.
Di problem be say Covid-19 be new disease and no be
something wey scientists don study - meaning di data wey dey available on di
subject dey small for now.
Children be super-spreaders for disease like flu but e be
like say e no be di same for coronavirus. Children dey top of disease
spreaders because dem like to touch touch but dem no dey wash dia hands every
time and dem dey dey close to oda pipo.
But scientific evidence show say only small number of children dey sick
sake of coronavirus. For evidence wey dey ground, children and adolescent dey
half likely to catch coronavirus as adult.
Scientist dey look di blood of children and adult around di
world to see how children fit spread coronavirus.
Some evidence show say
children spread di disease less dan adult. Nobody no why dis be. Also World
Health Organisation say kontris wey leave dia schools open no get big outbreaks
wey centre around schools.
Children fit catch coronavirus but nobody dey sure how fast
dem fit spread am as scientific evidence no dey to draw conclusions.
White House fear say Covid-19 cases fit rise sake of protest
PACEMAKERCopyright: PACEMAKER
Thousands of pipo protest on top di black man wey America police kill.Image caption: Thousands of pipo protest on top di black man wey America police kill.
US White House Coronavirus Task Force don draw ear give govnors for di kontri say di number of coronavirus cases fit rise sake of di massive Black Lives Matter protest wey di death of George Floyd cause.
For conference call wey di kontri vice-president Mike Pence bin do wit state leaders, im say, "we respect di right of every American to exercise dia First Amendment rights, but we dey encourage dem to do am safely."
Task Force expert Dr Deborah Birx tok for di meeting say, number of cases bin reduce dis recent week, but e no clear weda na di mask wey di protesters bin wear help prevent any additional spread - especially as higher-risk groups join peaceful demonstrations.
US no be di only kontri wey dey worry about how di Black Lives Matter protest go affect di pandemic.
Coronavirus: Outbreaks for Africa dey increase - WHO
EPACopyright: EPA
South Africa get highest number of Covid - 19 cases for AfricaImage caption: South Africa get highest number of Covid - 19 cases for Africa
Di
World Health Organization don warn say di spread of coronavirus dey increase seriously
for Africa.
According
to di global health body, South Africa, Nigeria, Algeria, Egypt, Ghana,
Cameroon, Senegal, Democratic Republic of Congo, Guinea and Côte d'Ivoire don
record di highest number of Covid-19 cases.
Di
sub Saharan Africa director for di WHO, Dr Matshidiso Moeti explain say di
reason for di increase na because testing materials don plenty for di region.
Moeti also tok say di lockdown rule wey many African goments put in place give
dem opportunity to screen many pipo and do plenty test.
Wetin
dey worry WHO now na di way di virus dey spread for different communities, dem
claim say dis community transmission, wey start from di cities don de yenta villages
small-small and health care systems for those places dey very weak.
From
di 200,000 reported cases for di continent, 75% dey for di sub-Saharan region.
WHO
figure show say South Africa get more than quarter of di continent cases.
Passengers for flights suppose ask permission before dem go
into toilet and comot row by row, according to one panel of aviation health
experts.
Di panel don make series of recommendations to di UK
Department for Transport on how to make air travel dey safe.
Di recommendations also include say passengers must wear
face wey dey cover dem all times and air crew suppose give dem alcohol-based wipes to clean dia table or oda surfaces.
However, di experts say make dem dey careful over
effectiveness of temperature screening and coronavirus swab tests for airports.
Airlines like Easyjet and Ryanair dey plan to start to dey
operate more flights later dis month.
Lawmakers for Ethiopia don extend dia time for office indefinitely
Lawmakers for Ethiopia don vote to extend di term of di
current goment and di Prime Minister Abiy Ahmed ‘indefinitely’.
Dis dey come afta dem agree to extend dia mandates and hold
national elections ‘nine to 12 months afta health authorities determine say e dey safe’ sake of coronavirus.
Objections wey odas tok be say no one sabi wen di Corona
Pandemic go end or whether di goment go seek oda postponements.
For Monday, Ethiopia upper house speaker Keria Ebrahim
resign as protest against di postponement of di elections wey dem don plan for
di Horn of Africa kontri.
Ghana Covid-19 cases cross 10,000 mark
Confirmed coronavirus
cases for Ghana cross ten thousand mark after de country record first case
March dis year.
Ghana Health
Service say dem record 291 new cases of of Covid-19 which push de total case
count go 10,201.
Number of
recoveries also dey increase steadily at 3,755 after some 110 people test
negative for de virus.
Number of people
wey die with Covid-19 dey stand at 48.
Out
of de total 10,201 total, de active Covid-19 cases for Ghana dey stand at
6,398.
Below be regional
distribution of de virus for Ghana
Live Reporting
By Daniel Semeniworima
All dem times wey dem write be UK
How to self-isolate to prevent di spread of Covid-19
Video content
We share 5 tips to epp anybodi wey need to, or dem don tell to self-isolate to prevent di spread of Covid-19.
Which part of di world coronavirus don hit di hardest?
Coronavirus don contribute to di deaths of one million pipo worldwide.
Read MoreCovid-19 deaths don pass one million across di world
Covid-19 cases death toll don pass one million across di world
Read MoreSee Lagos goment rules on facemask and social distancing and how e affect you
Gift Andrew
Reporter, BBC News Pidgin, Lagos
Govnor Babajide Sanwo-Olu on Sunday, May 17 bring out new rules as di state dey enter third week since dem begin to ease di lockdown.
Read MoreCoronavirus don reach all states for Nigeria- See everytin we know
Annette Arotiba
BBC News Pidgin
According to di latest report wey di kontri Centre for Disease Control release, Nigeria get 29,286 confamed cases of COVID- 19
Read MoreSee Nigeria Govnors wey don get coronavirus and how dia health dey now
Coronavirus no dey fear face or look weda pesin na Govnor or big oga as e dey catch four state executives for Nigeria.
Read MoreHow Fulani women no fit wait to dey waka again
Mansur Abubakar
BBC News Pidgin, Kano
Fulani pipo dey live nomadic lifestyle wey mean say dem dey always move from one place to anoda with dia cows.
Read MoreWetin we sabi about Naira Marley Abuja show wey make pipo dey tok
Pipo dey wonder how dis event go take place wen Nigeria goment neva give green light on social gatherings of more than 50 pipo and interstate travel still dey banned.
Read MoreUna Goodnight!
Dis na wia we go march break ontop our live coverage today.
No forget to join us tomorrow again.
You fit scroll down for Thursday tori dem.
Remember, make you dey wash your hands. Covid-19 dey rea
East Africa roll out plan wey go helep di economy ontop Covid-19 palava
Finance ministers for East Africa don list measures dem go use to take improve di economic impacts of coronavirus.
Di goment of Kenya, Uganda and Tanzania don all outline dia spending and taxation plan for budget announcements wey suppose happen on di same day.
Money wey goment for di three kontris don spend reach $52.6bn (£41.7bn).
For Kenya, di goment don put $500m to spend on tourism, manufacturing and agricultural sectors, wey dey affected by di measures dey cari out to stop spread of Covid-19.
To help pay for goment spending, Kenya’s Finance Minister Ukur Yatani don propose new tax on companies wey dey provide digital services, wey fit be controversial.
Uganda show plans to delay di payment of corporate and income tax to relief di burden on companies and employees.
Tanzania Finance Minister Philip Mpango stress say di government go maintain dia levels of spending but acknowledge say di pandemic go reduce economic growth from 6.9% to 5.5%.
Children fit spread coronavirus if schools reopen?
How likely e dey for children to catch and even spread coronavirus be frequent topic wen dem dey discuss whether to reopen schools.
Di problem be say Covid-19 be new disease and no be something wey scientists don study - meaning di data wey dey available on di subject dey small for now.
Children be super-spreaders for disease like flu but e be like say e no be di same for coronavirus. Children dey top of disease spreaders because dem like to touch touch but dem no dey wash dia hands every time and dem dey dey close to oda pipo.
But scientific evidence show say only small number of children dey sick sake of coronavirus. For evidence wey dey ground, children and adolescent dey half likely to catch coronavirus as adult.
Scientist dey look di blood of children and adult around di world to see how children fit spread coronavirus.
Some evidence show say children spread di disease less dan adult. Nobody no why dis be. Also World Health Organisation say kontris wey leave dia schools open no get big outbreaks wey centre around schools.
Children fit catch coronavirus but nobody dey sure how fast dem fit spread am as scientific evidence no dey to draw conclusions.
White House fear say Covid-19 cases fit rise sake of protest
US White House Coronavirus Task Force don draw ear give govnors for di kontri say di number of coronavirus cases fit rise sake of di massive Black Lives Matter protest wey di death of George Floyd cause.
For conference call wey di kontri vice-president Mike Pence bin do wit state leaders, im say, "we respect di right of every American to exercise dia First Amendment rights, but we dey encourage dem to do am safely."
Task Force expert Dr Deborah Birx tok for di meeting say, number of cases bin reduce dis recent week, but e no clear weda na di mask wey di protesters bin wear help prevent any additional spread - especially as higher-risk groups join peaceful demonstrations.
US no be di only kontri wey dey worry about how di Black Lives Matter protest go affect di pandemic.
Covid-19 no be di last pandemic? Dis na wetin we know
By Victoria Gill
Science correspondent, BBC News
Pandemic hunting scientists warn say 'perfect storm' dey for new diseases to come from wildlife.
Read MoreCoronavirus: Outbreaks for Africa dey increase - WHO
Di World Health Organization don warn say di spread of coronavirus dey increase seriously for Africa.
According to di global health body, South Africa, Nigeria, Algeria, Egypt, Ghana, Cameroon, Senegal, Democratic Republic of Congo, Guinea and Côte d'Ivoire don record di highest number of Covid-19 cases.
Di sub Saharan Africa director for di WHO, Dr Matshidiso Moeti explain say di reason for di increase na because testing materials don plenty for di region. Moeti also tok say di lockdown rule wey many African goments put in place give dem opportunity to screen many pipo and do plenty test.
Wetin dey worry WHO now na di way di virus dey spread for different communities, dem claim say dis community transmission, wey start from di cities don de yenta villages small-small and health care systems for those places dey very weak.
From di 200,000 reported cases for di continent, 75% dey for di sub-Saharan region.
WHO figure show say South Africa get more than quarter of di continent cases.
For you to use dis five Nigerian airports you must obey dis new rules
Fiona Equere
BBC News Pidgin
Afta more than two months wey Nigeria goment close down all di airport for di kontri sake of coronavirus, domestic flights go resume for June 21.
Read MoreHow plane passengers fit stay safe?
Passengers for flights suppose ask permission before dem go into toilet and comot row by row, according to one panel of aviation health experts.
Di panel don make series of recommendations to di UK Department for Transport on how to make air travel dey safe.
Di recommendations also include say passengers must wear face wey dey cover dem all times and air crew suppose give dem alcohol-based wipes to clean dia table or oda surfaces.
However, di experts say make dem dey careful over effectiveness of temperature screening and coronavirus swab tests for airports.
Airlines like Easyjet and Ryanair dey plan to start to dey operate more flights later dis month.
Lawmakers for Ethiopia don extend dia time for office indefinitely
Lawmakers for Ethiopia don vote to extend di term of di current goment and di Prime Minister Abiy Ahmed ‘indefinitely’.
Dis dey come afta dem agree to extend dia mandates and hold national elections ‘nine to 12 months afta health authorities determine say e dey safe’ sake of coronavirus.
Objections wey odas tok be say no one sabi wen di Corona Pandemic go end or whether di goment go seek oda postponements.
For Monday, Ethiopia upper house speaker Keria Ebrahim resign as protest against di postponement of di elections wey dem don plan for di Horn of Africa kontri.
Ghana Covid-19 cases cross 10,000 mark
Confirmed coronavirus cases for Ghana cross ten thousand mark after de country record first case March dis year.
Ghana Health Service say dem record 291 new cases of of Covid-19 which push de total case count go 10,201.
Number of recoveries also dey increase steadily at 3,755 after some 110 people test negative for de virus.
Number of people wey die with Covid-19 dey stand at 48.
Out of de total 10,201 total, de active Covid-19 cases for Ghana dey stand at 6,398.
Below be regional distribution of de virus for Ghana
Greater Accra Region – 6,521
Ashanti Region – 1,799
Western Region – 778
Central Region – 539
Eastern Region – 175
Volta Region – 158
Western North Region – 74
Upper East Region – 42
Oti Region – 38
Northern Region – 37
Upper West Region – 22
Bono East Region – 13
North East Region – 2
Savannah Region – 1
Bono Region – 1
Ahafo Region – 1
Pierre Nkurunziza last moment and how African leaders dey react to im death
Princess Igho Williams
Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
Africa leaders don begin react to di death of Burundi President, Pierre Nkurunziza plus send dia condolence to im family and kontri pipo
Read MoreUna Goodnight!
Dis na wia we go march break ontop our live coverage today.
No forget to join us tomorrow again.
You fit scroll down for Tuesday tori dem. But make we leave you with dis video from NCDC on how coronavirus take start.
Remember, make you dey wash your hands. Covid-19 dey real.