Alpha Jet aircraft: No be Boko Haram shoot down Alpha Jet aircraft wey crash

Wia dis foto come from, Nigeria Air Force HQ/Facebook
Di Nigerian Airforce don deny tori say na terrorists group Boko Haram shoot down di force Alpha Jet aircraft wey loss since March 31st for Borno State.
For one statement di force toktok pesin Edward Gabkwet say di videos wey dey circulate for social media no be correct video.
Tori be say videos show face for social media on Friday wia Boko dey claim say na dem shoot crash di aircraft wey dey rescue mission at di time. Di video show bodies of two dead pipo wey di terrorists group claim say na di two pilots wey dey inside.
But NAF say dis claim no be true at all and dat dem still dey analyse di video.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Twitter post
''NAF Alpha Jet aircraft fit don crash''
On Friday di Nigeria Air Force say intelligence report wey dem get dey show say di Alpha Jet aircraft (NAF475) wey bin disappear from radar wit two of dia personnel on March 31 2021 fit don crash.
E neva clear wetin cause di crash or wia di two pilots dey.
Di pilots na Flight Lieutenant John Abolarinwa and Flight Lieutenant Ebiakpo Chapele.
Di director of Public relations and information, Edward Gabkwet, inside statement say NAF surveillance aircraft, NAF Special Forces and Nigeria Army troops wey dey ground, still dey do extensive search and rescue.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Dem add say, at dis point, dem no dey rule out anytin concerning di mata but dem dey hope say dem go fit find and rescue di crew members soon.
Di force announce on Thursday say dem loss radar contact wit wit di Alpha-Jet at about 5:08 pm on Wednesday.

Wia dis foto come from, Screenshot







