Riyad Mahrez: Leicester winger don return to training since Manchester City transfer drama

Riyad Mahrez

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Mahrez bin dey hope say im go dey follow Manchester City play by now

Leicester winger Riyad Mahrez don train with di first team for di first time since di January plans for am to transfer go Manchester City no happen.

Di 26-year-old never follow im team-mates train since when Leicester bin reject £50m deal from di Premier League leaders on deadline day.

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI

Wetin we call dis foto,

Di club don promise say dem go support di 2016 BBC African Footballer of di Year player

On Thursday 9 February, Foxes coach Claude Puel talk say im no go select Mahrez for Saturday match against Manchester City.

E no dey clear now whether as di midfielder don train today, di manager go change im mind for tomorrow game.

Mahrez never play for Leicester since 20 January.