2018 Commonwealth Games: Ogbonge athletes wey don show face

Wia dis foto come from, Getty Images
Di 2018 Commonwealth Games start today for Gold Coast Australia.
With more than 4,500 athletes from 71 kontris dem wey go compete for 275 gold medals for di next 11 days of di competition.
See some ogbonge sportsmen and women wey don shine for di games before.
Usain Bolt
Wia dis foto come from, Getty Images
Usain Bolt first Commonwealth Games na for Glasgow 2014 wey im lead Jamaica 4x100m relay team to win gold.
Blessing Okagbare
Wia dis foto come from, Cameron Spencer
Africa fastest woman Blessing Okagbare shock Jamaica Veronica Campbell-Brown and Kerron Stewart to win 100 metres gold for di 2014 Games.
Frankie Fredericks
Wia dis foto come from, FRANCK FIFE
For 1994, Frankie Fredericks set 200m Commonwealth record wey still dey till today gidigba.
Dame Kelly Holmes
Wia dis foto come from, Huw Evans picture agency
Dame Kelly Holmes win gold for 1994 Commonwealth Games for 1500m.