World Cup 2018: How Cameroon win World Cup final for France

Wia dis foto come from, Getty Images
Both Mbappe and Umtiti get roots for Cameroon
Since weh deh sack African teams dem from World Cup for Russia, Cameroonians dem di support France strong-strong as deh know say dia blood di run for France e vein with two players weh deh di shine for de team.
Even as France dia team get plenti players from Africa and deh di call dis team sixth African team and Africa United, tori afta France komot Belgium with 1-0 win na say Cameroon qualify France for final.
- NEWS TORI: Cholera sickness don kill pipo for Cameroon/Nigeria boundary village
- 85-year-old President Biya wan spend seven more years as Cameroon president
- Belgium players wey quailfy to play for African kontris
- Modric win best player for World Cup
- 'Cameroon army video' wia soldiers shoot women and pikin dey shock pipo
Na Samuel Umtiti, 'Bassa boy' from littoral region weh deh born e for Yaoundé for 1993 head de ball inside net, de only 'mbunga' weh e land France for final.
Wia dis foto come from, Getty Images
Umtiti goal carri France enta World Cup final
For seka Umtiti e goal, Belgium weh deh get beta show for dis competition don pack dia kaya and deh play third place.
But Umtiti no be de only player weh e get Cameroon blood for France team, Kylian Mbappe na anoda player weh e get Cameroon blood.
Mbappe weh e di run laik lightening and weh e still bi only 19 years play beta football, and yesterday e make de Red Devils dem run fain-fain.
E di join for front with Griessman and Matuidi though dem miss for score plenti goals against Belgium for play beta ndamba.
- YOU FIT ALSO LIKE: Five steps you must take before you buy land
Mbappe e family weh e di stay for Bonapriso, (dia late uncle Eboa Lottin bi bi na some big musician) quarter for Douala di surely watch dia grand pikin touch ndamba with style.
For seka dis two players dem, Umtiti and Mbappe, fans dem di feel say na Cameroon qualify France for final and some pipo say na Cameroon reach finals.