Ronaldo agent, Juventus dey vex as Modric collect UEFA best player award

Wia dis foto come from, Getty Images
Mendes dey vex say UEFA suppose give Ronaldo wey score 15 goals for di competition
Cristiano Ronaldo agent Jorge Mendes on Friday say na "nonesense" wey UEFA do as dem give Real Madrid midfielder Luka Modric Men's Player of di Year award.
Real Madrid players dem collect almost all di awards dem wey happun for Monaco as dem do di draws for di Champions League group stage, Modric also collect di award of Champions League midfielder of di season.
Di only award wey Ronaldo get na best Champions League forward, meanwhile im former Real team-mate Sergio Ramos collect defender of di year and Keylor Navas win goalkeeper of di year.
But wetin dey pepper Mendes for body na say Ronaldo score 15 goals and finish di competition as highest goal scorer but dem still slide am.
Wia dis foto come from, Getty Images
Modric collect 313 points of di vote wey get 60 coaches and 55 journalists
As e be Modric collect 313 points of di vote wey get 60 coaches and 55 journalists from across Europe, to beat Ronaldo by 90 points with Liverpool's Mo Salah carry third.
Mendes tok to tori Portugal tori pipo outlet Record, say: "Na for field dem dey play Football and na dia Cristiano win.
Im score 15 goals, carry Real Madrid for im back and win di Champions League again.
Na nonsense, shame, No doubt, Ronaldo na di best for im position."
No be only Mendes wey belle no sweet oh! Juventus chief executive Giuseppe Marotta, wey buy Ronaldo to Turin for dis summer transfer window chook mouth for di matter too.
Oga Marrota tok say I no get anything against di journalists and coaches wey vote, but I for vote for Cristiano Ronaldo and I dey tok as football fan.
Champions League draw: Ronaldo dey go back Old Trafford, Tottenham dey go Camp Nou
Wia dis foto come from, Getty Images
Correct matches go land for dis season Uefa Champions league afta di draw wey dem do for Monaco, France.
Cristiano Ronaldo go face Manchester United, di club wey im bin play and win im first Champions League trophy.
Anoda correct match wey go happun na between Paris Saint Germain and Liverpool.
Barcelona go welcome Mauricio Pochettino and im Tottenham players for Camp Nou.
See di full list of di matches.
Group A: Atletico Madrid, Borussia Dortmund, Monaco, Club Brugge.
Group B: Barcelona, Tottenham, PSV Eindhoven, Inter.
Group C: PSG, Napoli, Liverpool, Red Star Belgrade.
Group D: Lokomotiv Moscow, FC Porto, Schalke, Galatasaray.
Group E: Bayern Munich, Benfica, Ajax, AEK Athens
Group F: Manchester City, Shakhtar Donestk, Lyon, Hoffenheim.
Group G: Real Madrid, Roma, CSKA Moscow, Viktoria Plzen
Group H: Juventus, Manchester United, Valencia, BSC Young Boys.