Salisu Yusuf: NFF neva decide if Super Eagles coach wey chop ban go return afta one year

Salisu Yusuf

Wia dis foto come from, Gabriel Rossi

Wetin we call dis foto,

NFF no tok if coach Salisu go return to im position afta di one year expire

Secretary General of di Nigeria Football Federation Dr Sanusi Mohammed say e dey too early to know weda Coach Salisu Yusuf go return to im position for Super Eagles afta im one year ban.

Dr Mohammed wey follow BBC Pidgin tori pesin Mansur Abubakar tok, say NFF board go soon meet to decide wetin go happun to di coach afta Nuhu Ribadu Ethics Committee say make im no touch anytin football again for one year.

"Wetin I go tok be say e dey too early to know wetin go happun afta e come back. Na NFF board go decide dat one and dem go meet very soon," im tok.

Nigeria Super Eagles go jam Seychelles on Saturday for African Nations Cup qualifier.

Di Nigeria Football Federation suspend coach Salisu Yusuf from everitin wey concern football for one year and also fine am $5000 wey im suppose pay within three months.

One investigation by BBC Africa Eye and Ghana journalist Anas Arameyaw Anas bin show as coach Salisu collect 'dash money' of $1000 to cari some players go di 2017 Wafu Cup of Nations.

Wetin we call dis Video,

Di film wey show as Nigeria football coach Salisu Yusuf dey collect cash

Na former chairman of di Nigeria corruption police EFCC Mallam Nuhu Ribadu lead di committee and dem say even though di coach collect di money, e no mean say dat wan influence im decision to cari di players go di tournament.

Di committee tok say no be mistake coach Salisu Yusuf take collect di money, but say na wit clear eye im use accept di gift of $1,000 from di undercover reporters wey pretend say dem dey work for Osas Okoro and Rabiu Ali wey be two players for di team. Dem say di players for fit make di team based on dia talent and performance.

"Say as di coach show well well for BBC as im dey collect money, damage di reputation and integrity of Nigerian Football, as im suppose behave well as per di Code of Conduct wey im sign for im contract wit di NFF.

"We follow wetin dey for Art. 22, FIFA Disciplinary Code, to ban am for di period of one year, from anytin wey concern football and also fine am di of $5,000 wey im go pay within three (3) months... di Committee also also rule say im no fit appeal dis decision.