Champions League quarter-final draw: Real Madrid jam Liverpool for repeat of Champions League 2018 final

Wia dis foto come from, Getty Images
Real Madrid go jam Liverpool for di quarter finals of di Uefa Champions League, di draws ceremony for di competition don reveal.
Di match go be repeat of 2018 finals wey see Los Blancos carry di trophy.
Oda matches of di eight teams na Man City vs Dortmund, Porto v Chelsea and Bayern Munich v PSG.
Di draw happen for Nyon, Switzerland on 19 March for di House of European Football, di heaquarters of Uefa.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Twitter post
Di first-leg of di quarter-finals go happun on 6-7 April while di second leg go be on 13-14 of di same month.







