Super Eagles: How to watch Nigeria Afcon qualifier against Benin Republic

Wia dis foto come from, @NGSuperEagles Twitter
All 24 invited players for Nigeria Super Eagles don land di kontri ahead of dia African Cup of Nations qualifying match.
Nigeria go play di Squirrels of Benin Republic, on Saturday March 27, 2021 for Stade Charles de Gaulle in Porto Novo.
Di Super Eagles dey top group L wit eight points followed by Benin wey get seven points.
Nigeria need just one point to book dia place for next year cup of Nations wey Cameroon dey host.
Di Super Eagles go travel by water to Porto Novo on Friday morning, and go spend di night for Beninoise capital, Cotonou before dem go move to Porto Novo on Saturday for di game.
Di team go return to Cotonou afta di game and travel back to Lagos on Sunday morning.
Nigeria team news
These na di players wey dey camp:
Goalkeepers: Maduka Okoye, Francis Uzoho, John Noble;
Defenders: William Ekong, Olaoluwa Aina, Adekunle Adeleke, Chidozie Awaziem, Leon Balogun, Tyronne Ebuehi, Jamilu Collins, Zaidu Sanusi;
Midfielders: Semi Ajayi, Oghenekaro Etebo, Abdullahi Shehu, Joseph Ayodele-Aribo, Wilfred Ndidi;
Forwards: Ahmed Musa, Henry Onyekuru, Anayo Iwuala, Alex Iwobi, Paul Onuachu, Samuel Chukwueze, Victor Osimhen, Kelechi Iheanacho
How to watch Benin vs Nigeria match?
Di match go start 5pm Nigeria time and na for Charles de Gaulle stadium for Porto Novo dem go play di match.
For now, no Nigeria station go broadcast the match Live but Nigeria football federation don announce say dem go stream di match live online for NFF TV
And on Nigeria Super Eagles (Verified) Facebook page and on Nigeria Super Eagles YouTube Channel.
See fotos of how some Super Eagles players fall in camp
Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuperEagles
Kelechi Iheanacho
Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuperEagles
Alex Iwobi
Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuperEagles
Tyronne Ebuehi
Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuperEagles
Abdullahi Shehu
Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuperEagles
Joseph Ayodele-Aribo
Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuperEagles
Leon Balogun