Afta many sleepless nights, one of di fathers of di Kidnapped Government Girls Secondary School students fit sleep well now afta Zamfara state confam release of 279 students.
Di state commissioner for security and internal affairs tell BBC say na total of 279 students dem release and di previous figure of 317 wey police bin report wey dey missing no dey correct.
One of di father of di kidnapped students for Government Girls Secondary School Jangebe don share wit BBC Pidgin how im feel wen news of daughters kidnap reach e ear.