Africa's week in pictures: 2 - 8 February 2018
Dis na selection of correct fotos dem from all over Africa and Africans wey dey oda place dis week.

Wia dis foto come from, AFP
Two young women show for di welcoming ceremony for students on Saturday for eastern Democratic Republic of Congo...
Wia dis foto come from, AFP
Dis sharp dresser also show for di event for di town of Beni.
Wia dis foto come from, AFP
Di new students wey just register for university dey enter for dia first year.
Wia dis foto come from, AFP
Dem find dis ogbonge painting wey miss - wey Nigerian painter and sculptor Ben Enwonwu do - for one house for London and e fit cost reach £300,000 ($417,000) for auction.
Wia dis foto come from, AFP
For Thursday, hundreds of protesters gather for outside di Rwandan embassy for di Israeli city of Herzeliya to protest against tough new migration laws wey many people think say no favour Africans.
Wia dis foto come from, Reuters
NTV tori people dey broadcast from dia studio for Kenya on Tuesday, one day after government allow di network back on air along with KTN News. Another channel, Citizen TV, done come back too - dem comot di thrre stations after dem broadcast opposition leader Raila Odinga swear-in as "people's president".
Wia dis foto come from, AFP
On dat same day, Nigeria's women's bobsleigh and skeleton team members Seun Adigun, Ngozi Onwumere, Akuoma Omeoga and Simidele Adeagbo dey pose for cameras for di welcoming ceremony of di 2018 Winter Olympic Games for South Korea.
Wia dis foto come from, AFP
On Saturday, one worshipper dey prepare for di yearly Hindu Thaipoosam Kavady festival near Durban for South Africa...
Wia dis foto come from, AFP
For di ceremony, worshippers go pin tees pin coconuts, fruits and flowers for dia bodi to show suffer head.
Wia dis foto come from, AFP
On di same day for Durban, Rastafarian reggae fans gather for di Bob Marley Earthday Festival and Rasta Fair.
Wia dis foto come from, AFP
Also on Saturday, one person wey go tomb wey dem just find for Giza plateau for Cairo dey take foto of di wall paintings wey still dey kampe.
Wia dis foto come from, AFP
On Monday for South Africa, supporters of governing ANC leader Cyril Ramaphosa carry placards dey shout and sing outside party headquarters for Johannesburg say President Jacob Zuma must comot office.
Wia dis foto come from, AFP
On Friday, one Senegalese guard of honour dey wait at di airport for a ceremony to welcome French President Emmanuel Macron to Dakar...
Wia dis foto come from, AFP
Pop singer Rihanna and di French president join attend di summit for di Global Partnership for Education for di Senegal capital.
Wia dis foto come from, AFP
On di same day, one miner dey wave from inside bus after over 900 miners trap underground after power cut for Theunissen, South Africa.
Wia dis foto come from, AFP
Meanwhile on Friday, one warden tanda for Oukacha prison wey dey Moroccan city of Casablanca.
Images courtesy of AFP, Reuters, and Getty Images