Eko Atlantic City Project: Buhari say im no commission am

Buhari and Ambode

Wia dis foto come from, Akinwunmi Ambode

Wetin we call dis foto,

Presido Buhari say wetin im do for di Eko Atlantic Project na to 'open sign'

Presido Muhammadu Buhari hand don full in di last two days, as im dey correct pipo upandan for twitter about wetin im do and no do. Di latest na di Lagos State govnor Akinwunmi Ambode.

Presido Buhari wey bin dey Lagos for two days official visit wia im waka enta some kain projects for di state, enta twitter Saturday afternoon to say im no 'commission' di Eko Atlantic City Project.

Dis na afta di Lagos State govnor bin say na wetin im come do.

Di tin be say for 2013, forma Presido Goodluck Jonathan, togeda with forma America presido Bill Clinton and den Lagos State govnor Babatunde Fashola bin 'commission' dis same Eko Atlantic City Project.

Wia dis foto come from, Eko Atlantic

Wetin we call dis foto,

Dis no be di first time wey presido Buhari go 'commission' something wey dem don 'commission' before

Even as Buhari tweet, e no stop Nigerians to jump enta di mata:

Even dis popula supota of oga presido:

On Friday, di Nigeria presidency bin also correct model Naomi Campbell wey bin say na oga Buhari invite her come im waka for di Eko Atlantic City Project. She come later delete her first tweet wey say na di presido invite her. Trust na, pipo don begin wonda: