Why Sierra Leone shut down internet after election

Wia dis foto come from, SEYLLOU
Tori wey show for Sierra Leone say e be like say government shut down internet after di second round presidential election wey dem do on Saturday 31 March.
BBC tori pesin Umaru Fofana nack di tori put for Twitter dis early momo.
Oda pipo sef follow share di mata.
Pipo wey dey chook eye for internet mata, Open Observatory Network Interference, confam di tori because google statistics show say search for Sierra Leone reduce around dat time.
Sierra Leone Decides, di group wey dey monitor election, say internet service providers talk say internet shut down so di National Electoral Commission and oda pipo no go fit share result give party pipo.
Authorities neva say weda true-true, di thing happen.
Citizens dey wait to see who go be di next president after ruling APC candidate Samura Kamara lock horn with opposition SLPP candidate Julius Maada Bio to replace current president Ernest Bai Koroma.