Winnie Mandela don die

Winnie Madikizela Mandela wey be di former wife of South Africa first black president, Nelson Mandela don die at di age of 81
Winnie na one of di main pipo wey follow former president Nelson Mandela fight against apartheid for South Africa.
She be one of di pipo wey help start South Africa ruling ANC party.
Her PA‚ Zodwa Zwane na im confirm di tori on Monday afternoon.
We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.