'Herdsmen' don kill two priest and 13 worshippers for Benue State

Benue Killings

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Suspected herdsmen don kill plenty pipo for Benue.

Suspected Fulani herdsmen don kill two catholic priests and 13 worshippers for Ayar-Mbalom community for Gwer East Local Government Area of Benue State.

Di armed herdsmen attack St. Ignatius Catholic Church, Ayar-Mbalom on Tuesday during morning mass, according to one source wey no wan mention im name.

Di source say di Catholic priests wey die na Rev. Fr. Joseph Gor and Rev. Fr. Felix Tyolaha.

Di attackers dem also burn down 50 houses and pursue everybody inside di community comot.

Dis attack dey come just four days afta herdsmen kill 10 pipo for Guma local government area.

Buhari don condemn attack

President Muhammadu Buhari describe di attack as satanic, say dem go find di pipo wey do am, and make dem pay.

For statement wey di Special Adviser to di President on media and publicity Femi Adesina release, di president tell di goment and pipo of Benue State sorry.

"Dis latest attack on innocent pipo na very bad tin. To violate place of worship, kill priests and worshippers na evil and satanic tin, and e dey clear say dem wan cause religious katakata and make communities jam dia head wey go cause bloodshed," di president talk.