Wetin be dis tok say Buhari threaten Nigeria Vice President Osinbajo

Nigeria Vice President Yemi Osinbanjo

Wia dis foto come from, Instagram - @YemiOsinbanjo

Wetin we call dis foto,

Yemi Osinbanjo

Di joke wey President Muhammadu Buhari bin tok when female lawmakers visit am for Aso Rock don buy market.

Tori be say di visitors bin dey give speech, tok say dem want di President to make woman im Vice President.

President Buhari come reply dem say dat one mean say dem wan threaten Vice President Yemi Osinbajo position be dat.

"Na pity say di VP no dey here, but I believe say di secretary to the goment go tell am say im position dey threatened. Na only di Vice President don chop threat. And if we win di next election, im fit lose im election."

Na wetin Buhari tell im visitors on Friday.

Wia dis foto come from, Aso Rock

Wetin we call dis foto,

Dis na where di joke happen

E no tey afta President Buhari nack di joke pipo carry di mata enta social media.

Reno Omokri wey sabi yab di Buhari goment follow chook mouth for di mata.

Vice Presido bin say im ready to comot office

Di joke dey happen one week afta tori land say di Vice Presido bin say im ready to comot office with short notice.

Na on May 17 wen e go Benue state, north central Nigeria on top di kill-kill of Christians for di kontri, e tok dis one.

President Buhari PA Bashir Ahmed sharperly clear di presido tok, say na only joke im dey joke give di Conference of Nigerian Female Parliamentarians wey visit am for Aso Rock.

'I go advice am to dey careful about im jokes'

Wia dis foto come from, Idowu Sowunmi

Wetin we call dis foto,

Idowu Sowunmi sabi follow waka wey dey happen inside Nigeria president office

'If me I fit advice President Muhammadu Buhari, I tell am to dey careful about im kind of jokes,' na wetin Idowu Sowunmi wey be Nigerian tori pesin tok give BBC Pidgin.

E no reach 10 minutes afta di joke land, pipo begin give am different meaning.

Somebodi even tok say e neva tey wen VP say im ready to comot office with short notice, now di President dey tok say im wan remove am.'

Sowunmi add say: 'Make pipo remember say to pick VP involve wetin political party go decide, so me I go say na just different meaning dem dey make out of di joke. Na im make I go advice di presido to check di kind of jokes im dey take play with pipo.'