Ekiti election update: 'I win Fayemi wit 70 percent vote, INEC call anoda result' - Eleka

Govnor-elect Kayode Fayemi (na im dey left) and PDP Candidate Olusola Eleka (na im dey right) inside dis foto.
Wetin we call dis foto,

Govnor-elect Kayode Fayemi (na im dey left) and PDP Candidate Olusola Eleka (na im dey right) inside dis foto.

'I reject di result wey INEC declare for di 14 July governorship election for Ekiti state. I win Fayemi wit 70 percent vote, INEC call anoda result, so I go challenge am' Na wetin Professor Olusola Eleka tok.

Eleka tell tori pipo on Sunday evening say na 'federal power' na im di ruling APC use force Independent National Electoral Commission - INEC hand to write result to favour dem.

INEC Chief returning officer Professor Idowu Olayinka wey declare di results for INEC state collation centre inside Ado- Ekiti State say All Progressives Congress Kayode Fayemi collect total of 197,459 votes from all di results to win di election.

Rigging full inside di vote, we reject di result - PDP

Wia dis foto come from, Tweet/@OfficialPDPNig

Wetin we call dis foto,

Opposition PDP bin first tweet dis foto on Saturday night claim say dem dey aware of plan by di ruling party APC to rig di election

Nigeria main opposition Peoples Democratic party - PDP on Sunday afternoon reject di results of di 14 July governorship election for Ekiti state.

But PDP tell tori pipo on Sunday say dem no go accept wetin INEC don declare.

'From result wey dey our hand, our candidate Professor Olusola Eleka beat di APC candidate Kayode Fayemi' Na wetin PDP claim.

Dem tweet on Sunday afternoon say di July 14 Ekiti governorship vote na rigging full inside.

'Rigging, katakata no dey my election' - Kayode Fayemi

'Kataka, rigging no dey my election,' na wetin Kayode Fayemi tell BBC just afta Independent National Electoral Commission - INEC declare am govnor on Sunday morning.

Fayemi say 'dis election dey free and fair, no katakata, no fight-fight, no trouble.'

'Nobody fit kwesion say wuruwuru dey, di vote correct, yes di card reader bin get small small issues, but dis election na one of di freeest process if you compare to di one wey happen for 2014.'

'I must thank di Ekiti pipo for dia patient to ensure say dem decide di future of our state'

Wia dis foto come from, Kayode Fayemi/Facebook

Wetin we call dis foto,

Kayode John Fayemi bin be govnor of Ekiti between 2010 and 2014, so dis na im number 2 times to be govnor.

'God don make evri of our plan come to pass. Sake of say notin happen wey for spoil my expectation and wetin i dey hope for'

E tell tell BBC Yoruba tori pesin Ahmad Ambali dis one just afta tori enta im house say INEC don declare am di winner.

Heavy jubilation as INEC declare APC candidate Kayode Fayemi

Wetin we call dis foto,

Evribodi both young and old don run enta road dey celebrate di victory wit songs and dance .

Heavy jubilation happen for Ado-Ekiti, di capital of Ekiti State southwest Nigeria afta Independent National Electoral Commission - INEC on Sunday morning declare Kayode Fayemi winner

Nigeria ruling party APC candidate Kayode Fayemi na di tear rubber govnor wey go replace di current govnor Ayodele Fayose become Ekiti Govnor from October dis year until 2022.

Di APC party carri extra 19,338 votes win PDP candidate Olusola Eleka wey get 178,121 votes.

APC win 12, while PDP win four out of di 16 local goment areas for di INEC result wey dem declare

Wia dis foto come from, @MBuhari/Twitter

Wetin we call dis foto,

Presido Muhammadu Buhari don send Fayemi congratulobia on top im victory.

Presido Buhari hail di All Progressives Congress (APC) candidate and all party supporters for di win wey dem win afta dem do campaign wey get value.Buhari beg di govnor-elect and APC members to try relate wit odas as dem win even as di new goment dey prepare new style of life for di pipo of Ekiti State through purposeful and responsible administraton.E also tuale for security pipo wey follow do di election. According to Presido Muhammadu Buhari di security agencies creating di right weather for di kain peace dem take organize di vote and beg dem to sustain di peace.

Di Presido also beg those wey lose to sey strong accept say dem loose and follow wetin dey law book to settle whatever tin wey no sweet dia belle instead of to do as dem like say dem dey epp dem sef.

Meanwhile Nigeria ruling party don also sama congratulobia give Fayemi.

Wetin we call dis foto,

Evribodi both young and old don run enta road dey celebrate di victory wit songs and dance .

Fayemi bin be Minister of Solid Minerals for Buhari goment until 30 May, before e resign go contest di 14 July election.

APC, PDP results INEC collation officers announce

Ado-Ekiti

APC - 28,111

PDP - 32,810

orisun: INEC

Ekiti South West

APC - 11,015

PDP - 8423

Ekiti East

APC - 12,778

PDP - 11,564

Isẹ/ọrun

APC - 11,908

PDP - 6297

Ikọle

APC - 14,522

PDP - 13,961

Ekiti West

APC - 12,648

PDP - 10,137

Ikẹrẹ - Where PDP candidate Olusola Eleka come from

APC - 11,515

PDP - 17,183

Emure

APC - 7048

PDP - 7121

Gbọnyin

APC - 11,498

PDP - 8027

Ijero

APC - 14,192

PDP - 11,077

Moba

APC - 11,837

PDP - 8520

Ẹfọn

APC - 5028

PDP - 5192

Ọyẹ - Where APC candidate Kayode Fayemi come from

APC - 14,995

PDP - 11, 271

Ilejemeje

APC - 4153

PDP - 3937

Irẹpodun/ifẹlodun - Where di current govnor Ayodele Fayose come from

APC - 13, 869

PDP - 11, 456

All di tori as e dey happen for di governorship vote.

Wetin we call dis foto,

Ward 6 Emure Ekiti na im dis one bin happen on Saturday afternoon

BBC tanda full ground for Ekiti dey follow wetin happen for Saturday 14 July governorship election for southwest Nigeria.

Independent National Electoral Commission - INEC wey dey organize di vote announce on Saturday evening say dem dey count result.

'If dem tiff your ballot box, no come back house' - Govnor Ayodele Fayose

Wetin we call dis foto,

Govnor Ayodele Fayose bin sama warning give pesin for fone on Saturday immediately e hia say tins don begin spoil for some areas of Ekiti.

Around 2 O'clock on Saturday afternoon afta Govnor Ayodele Fayose vote for di Ekiti governorship election, tori land im ear say tins don dey scata.

As chief security officer of di state, im recieve fone call. E first ask 'what is di situation?'

Govnor Ayodele Fayose sama di warning give pesin for fone immediately e hia say tins don begin spoil for some areas of Ekiti.

See im next reply for dis BBC News Pidgin Facebook video:

Ekiti Election: INEC don begin declare unit result, confam say dem tiff ballot box

Wetin we call dis foto,

INEC say Saturday voting start by 8 O'clock for 98 per cent of all di 2451 polling units.

National Electoral Commission, INEC wey dey organize di Ekiti state governorship election don confam say bad dem tiff ballot box for some local goment area on Saturday 14 July.

Ekiti State INEC Resident Electoral Commissioner Professor Abduganiyu Raji tell BBC on Saturday afternoon say dem tiff ballot box and scata di election for like 7 voting points.

E say na for just seven out of 2,451 voting points na im dem scata tins.

Tori from BBC tori pipo wey full ground for Ekiti say INEC pipo don declare unit result for some voting areas.

For where APC Candidate Kayode Fayemi vote unit results don show, even for where PDP Candidate Olusola Eleka, and for Prince Adeyeye unit, vote result don show.

Make e for no loss, even British Ambassador Paul Arkwright wey follow monitor tins for Ekiti as independent observer tweet dis around 4 O'clock.

INEC also tweet say dem don count ballot evriwia.

Tori from Ward 6 Emure Ekiti say bad gang don go scata tins for di area.

BBC understand say di pipo wey scata di election come run comot afta dem break di ballot box, throway di ballot papers.

Police dey pursue di pipo, according to tori.

Meanwhile more than 20 buses wey cari soldiers enta Ekiti on Saturday afternoon, according to wetin BBC tori pipo carri eye see.

Na exactly 12 O'clock na im we tori pipo see di soldiers enta di soldiers.

Wetin we call dis foto,

Where exactly dem dey go, nobodi know for now.

For Okehinmi ward 6 unit 5, PDP and APC supporters dey quarrel on top wetin we tori pipo observe say dem dey see and buy votes.

Voters accuse apc and police say dem dey only allow pipo who wan to vote APC to vote, na wetin BBC see on ground.

See sharp sharp video from di election.

IF YOU FOLLOW DI WORLD CUP YOU GO LIKE: First gold, Second silver, Third bronze, England wetin?

For Ward 7, unit 5, St Andrews Primary School. Oke Ila, Ado Ekiti Police don arrest two voters. Tori be say di voters complain say some party agents dey thumb print for old people wey come to vote.

But police spot one BBC tori pesin dey take take pictures, come seize im camera, delete di pictures come give am back im Camera.

Wetin we call dis foto,

Di soldiers dey well armed.

Card reader no allow PDP candidate vote

Wetin we call dis foto,

Eleka dey ask wetin happen to im record wey make card reader do gree work

Card reader no allow PDP Candidate Olusola Kolapo Eleka to vote on Saturday morning for di Ekiti governorship election.

Na around 9 O'clock e waka come out to vote for Ward 2, Unit 7, Okeruku Ikere-Ekiti but di card reader no fit find im information for im Permanent Voters Card PVC so e waka go back.

Professor Eleka tell BBC say whether di card reader allow am to vote or not, e go win di election.

Wetin we call dis foto,

Now e don vote.

Afta di card reader reject am, INEC pipo give Eleka pen and paper to write e name so dat e fit vote without card reader.

Wetin we call dis foto,

Meanwhile APC Candidate Kayode Fayemi don vote

Plenti voters show face early mor mor on Saturday to vote for Ekiti governorship election, even pipo from Independent National Electoral Commission, INEC wey dey organize di vote don tanda wit election materials for some voting point.

Wetin we call dis foto,

INEC dey expect over six hundred thousand voters to participate

INEC dey expect over six hundred thousand voters to participate.

Wetin we call dis foto,

Nigeria police send 30, 000 police men to do security for di election

Observer Wariboko Wariboko wey be INEC domestic observer dey tell BBC tori pipo wey full ground for Ekiti on Saturday morning say 'tins dey work di way we expect am. Security, Inec officials, observers and evribodi don show face to vote. Even di area calm dis morning.'

Wetin we call dis foto,

Na 34 candidates dey contest for govnor.

INEC say voting point for Ekiti governorship election go open from 8 O'clock on Saturday morning.

Wetin we call dis foto,

Pipo don already show face early mor mor to vote on Saturday.

Na total of 2,195 polling units dey inside all di 16 local goment areas of di state wey tanda for southwest Nigeria.

Wetin we call dis foto,

Voting don start for some polling units for di Ekiti state govnorship election.

Pesin wey win Saturday election go replace di current govnor Ayodele Fayose become Ekiti Govnor from October dis year until 2022.

Wetin we call dis foto,

Corpers wey dey work as INEC dey prepare voting point for Ward 2, Unit 7, Okeruku Ikere-Ekiti where di PDP Candidate Prof. Olusola Eleka go cast im vote on Saturday.

Wetin we call dis foto,

Both mama, papa, young pipo don full for wia dem go vote on Saturday for some polling unit inside Ekiti

Voters dey collect N4,000 bribe for PVC

On Friday as evribodi dey ready diasef for di Ekiti governorship election on Saturday BBC get exclusive video wey dey show as dem dey bribe some of di voters.

Di video wey comot on di eve of di election (Friday, July 13) dey show as some pipo for di capital, Ado-Ekiti. dey run make dem no miss out as dem dey share moni.

Wetin we call dis foto,

Some of di voters wey wan collect di bribe

"Moni, four, four thousand...for di pipo wey go vote tomorrow," na wetin one woman tok.

Anoda woman tok say dem tell her say make she vote for PDP.