Nigeria 2019 election: Atiku dey fear say Buhari no go gree go

Former Nigeria vice president Atiku Abubakar

Wia dis foto come from, Getty Images

As Nigeria dey enta gear two for di general lection wey go happun for 2019, one of di main candidates wey wan contest di election dey fear say kasala go bust.

Former Vice President, Atiku Abubakar on Monday tok say e dey fear for Nigeria say President Muhammadu Buhari go hand ova, even if e loose di election.

Oga Atiku, wey just buy form to contest 2019 presidential election inside opposition Peoples Democratic Party - PDP , tok on Monday say di characters wey dey run tins for di kontri now no be di same as 2015.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

President Buhari and oga Atiku work togeda to defeat former presido Goodluck Jonathan

E say say na retired general wey no ready to comot for office na im dem dey face now.

Mr Atiku - as Nigerians dey like to call am, na di deputy to former President Olusegun Obasanjo and di two no dey see eye to eye.

Plenti big-big politicians, plus including oga Atiku, run leave People's Democratic Party (PDP), wey dey rule between 1999 and 2015, join hand inside All Progressives Congress (APC) to win and pursue former presido Goodluck Jonathan comot goment for 2015.

Wetin we call dis Video,

Buhari no go hand ova for 2019 - Fani-Kayode

Now Mr Atiku don tok ay oga Jonathan na "peaceful, very patriotic Nigerian" wey im head correct.

No be today wey Nigeria don face serious election gbege.

Security sef na anoda problem wey goment dey struggle to solve as dem still neva chase Boko Haram comot northeast part of Nigeria.

Wetin we call dis Video,

APC mass defection: 'Maybe rice price go reduce'

Oda kill-kill between farmers and herdsmen don show for many states for di kontri.

But on top all of dis, oga Buhari don promise world leaders say say di 2019 election go dey free and fair.