Missing General: Nigeria army don see grave wia bad pipo bury Maj. Gen. Mohammed Idris Alkali

Wia dis foto come from, Other
General Alkali, bin retire few weeks before dem declare say e dey miss on Monday, September 3, 2018
Nigerian Army on Friday claim say dem don discover shallow grave wia dem suspect say bad pipo use take bury di body of former Chief of Administration, Major General Mohammed Idris Alkali (rtd).
Army tok say di shallow grave, dey for 'No Man's Land,' and four different suspects wey dem arrest for different times, na im don identify am.
Di General Officer Commanding three Armoured Division inside Rukuba Barracks, Major Geneneral Benson Akinroluyo say di suspects carri di troops wey dey do search-and-rescue operation go di spot wia dem bury di corpse of di missing officer.
Jos Pond of Death dey inside Dura-Du district for Plateau central Nigeria
But tori say dem don bin don dig di body comot and rebury am for anoda place wey dem no know.
Di bad pipo wey commit di crime, share di belongings of di missing officer afta dem kidnap am, according to oga Akinroluyo,
General Alkali, bin retire few weeks before dem declare say e dey miss on Monday, September 3, 2018, a day afta gunmen kill about 13 pesins for Dura-Du District, Jos, Plateau state, north central Nigeria.
Missing General #JosPond: Our life no dey safe, soldiers dey intimidate us - Dura-Du district resident
Di soldiers tok say di tori wey dey spread for social media say dem don recover 11 motor and two deadi bodi na fake news.