Bad gang for Nigeria don release 12 Swiss cargo ship crew members wey dem kidnap

Twelve crew members of one Swiss cargo ship wey dem kidnap for Nigeria for September don finally free.
Bad gang bin kidnap di sailors on top MV Glarus ship last month as e dey transport wheat from Lagos, southwest Nigeria go Port Harcourt wey dey south-south of di kontri.
- Kidnap suspect wey take tramadol come sleep for six days fit die - Doctor
- Mikel hear say dem kidnap im papa hours before Nigeria play Argentina
Tori pipo AFP/APP report say Swiss officials don confam say dem don cari di kidnap victims go back Switzerland.
Di crew members na seven Filipinos, one Bosnian, one Croatian, one Romanian, one Slovenian and one Ukrainian.
Massoel Shipping, wey get di ship, na dem do negotiation wit di kidnappers.
German tori pipo, Blick, tok say di pirates na members of di Movement for the Emancipation of the Niger Delta, MEND.
E neva clear weda dem pay any money but di pirates no gree release di cargo wey dem seize.