Senator Ademola Adeleke dey face court charge for exam fraud

Senator Ademola Adeleke

Wia dis foto come from, Ademola Adeleke/Facebook

Court on Wednesday charge Nigeria dancing senator Ademola Adeleke and four oda pipo unto accuse of exam wayo.

Na for di Federal High Court Abuja dem do hearing for di case.

Senator Adeleke wey contest for Osun state Govnor under di People's Democratic Party deny all di accuse.

Di oda pipo wey di court dey charge na Sikiru Adeleke wey be di principal of Ojo-Ara Community Grammar School, Alhaji Aregbesola Muftau wey be di registrar of di school, Gbadamosi Ojo, and Dare Samuel Olutope wey be teacher for di school.

As e be so, Police don give oga Adeleke bail.