Minimum wage in Nigeria: How you fit survive on N30,000 monthly
- Ogechi Obidiebube
- BBC News Pidgin, Lagos

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria President Muhammadu Buhari signing of di new minimum wage bill of N30,000 enta law go mean say di least paid worker for public sector go begin dey earn dat amount instead of di N18, 000 dem bin dey collect before.
Nigeria Labour congress want President Buhari goment to begin pay di new minimum wage from May, 2019 to mark Workers' Day.
Di senate bin pass di bill on Tuesday 19 March afta dem receive report from di committee wey dey in charge of di national minimum wage mata.
For 2018, di House of Representatives bin pass di bill wey set N30,000 as minimum wage for both federal and state workers.
President Muhammadu Buhari bin send di bill by January 2019 for torch lighting afta di National Council of State bin approve am.
How you fit survive on N30,000 per month salary for Nigeria
Some kontri don complain say salary of N30,000 per month too small but dis na some tins ways wey you fit survive on dis kain moni evri month.
1. Housing
Wia dis foto come from, Getty Images
If you dey live for Lagos and you dey collect dis kain salary evri month, e go hard to see beta house wia di rent no go tear your pocket.
Nigeria get plenti oda states wey you fit go stay wey house rent no too cost like dat.
Financial sabi pipo dey advise say your yearly rent no suppose pass your 3 months salary, so for dis case, your rent no suppose pass N90,000 per year.
2. Feeding
Wia dis foto come from, Getty Images
Beta soup na moni kill am but concoction rice still no bad like dat.
You go save more moni if you dey cook for house dan to dey buy food for outside. You fit arrange small soup and eba wey fit last you up to one week wit less dan N1500.
Some correct Nigerian soups wey you fit cook wit shikini moni na Egusi, Ogbono, Okro and Ewedu. Add N400 for one paint of garri and food don set be dat.
3. Clothing
Wia dis foto come from, Getty Images
Some pipo say 'na mumu dey go boutique'. Wetin dey carri you enta boutique wen you fit go okrika markets, bend down select beta akube.
Wen you wash am wit detergent wey dey scent well-well, starch am, iron am well, even pesin wey dey wear designers no go believe say na akube you deck. All na packaging.
4. Start side hustle
Wia dis foto come from, Getty Images
Small side business wey you fit dey do afta you close from office or for weekends, go reli help increase di total moni wey dey enta your pocket evri month.
You fit learn handwork wey you go dey make moni from wen you don sabi am well-well.
Find business wey you need small moni to start or di one wey you no even need any moni at all to start.
5. Jolliment
Wia dis foto come from, Getty Images
All hustle and no jolliment go turn you to dodoyo. E dey veri important to enjoy yoursef but you no need to spend your life savings on top jolli jolli.
Some places wia you fit enjoy free jolliment na party for church, mosque office party and weddings.