Calabar Carnival 2018: See as bikers parade go down

Calabar Carnival biker's parade
Wetin we call dis foto,

Former govnor of di state Donald Duke na one of di biker's wey been dey on show.

One of di many shows inside di Calabar Carnival na di Bikers parade wey shele on Thursday, di second day of di carnival procession.

Different ogbonge bikers from different parts of Nigeria show plus including politicians like former Cross River state governor Donald Duke and di current govnor Benedict Ayade.

Bikers parade na new addition wey govnor Ben Ayade bring to improve di Calabar Carnival and di idea na to attract young pipo.

Dis na some of di correct moments during di show wey carri local and international bikers enta Calabar southern Nigeria.