Walter Onnoghen dey guilty as charged - Code of Conduct Tribunal

Wia dis foto come from, KOLA SULAIMON
Nigeria Code of Conduct Tribunal say di kontri Chief Justice, Walter Onnoghen dey guilty of magomago accuse wey carri am come dia dormot. Justice Onnoghen wey dey on suspension, land di Tribunal say im no declare evri-evri im get, wen im enta office of Chief Justice of Nigeria.
Di three man panel of di Tribunal wey siddon, say make oga Onnoghen no hold any public office for 10 years, and say make im forget all di moni wey dey im five acounts, as e don become federal goment own.
Di Tribunal chairman, Danladi Umar wey read di judgement, order make Justice Onnoghen comot sharperly from chair, as CJN, Chairman of di National Judicial Council and di Chairman of di Federal Judicial Service Commission.
Onnoghen bin ask di court make e set am free because goment neva fit prove dia case against am but goment lawyers say dat one na lie say make di court sama Onnoghen big punishment because e commit di offence wey public officer no suppose do.
Onnoghen argue say goment no follow di proper channel wey be NJC to decide im mata and so di court must dismiss di case like e do for one justice Sylvester Ngwuta before before.
On April 5, 2019, tori be say di suspended Chief Justice resign wit immediate effect afta di National Judicial Council chook eye come send dia recommendation of compulsory retirement for Onnoghen give president Buhari.
But di court refuse say di trial must finish and di judgement today go decide weda Onnoghen dey innocent or not.
"Today na sad day for democracy"
Lawyers react of Onnoghen ruling
Afta di CCT pass im judgement, Okon Efut, SAN wey be Justice Onnoghen lawyer, say dis na di sadest day for di judiciary and Nigeria democracy. E explain give say wetin happun for court dey against natural justice and say di court no give Onnoghen fair hearing. Im say dem go challenge di mata and say even if court for Nigeria no give dem Justice, God go give dem.Meanwhile di prosecution counsel, Musa Ibrahim Usman say dem happy well for di court judgement.