Sri Lanka explosions: Easter Sunday bombing don kill at least 207 pipo

Wia dis foto come from, AFP
Blast damage for di Shangri-La hotel for Colombo
At least 207 pipo don die and hundreds of pipo wunjure for explosion for church and hotel for Sri Lanka according to reports.
Na eight explosions local media dey report say don happun for today wey be Easter Sunday.
Di explosion target three churches for Kochchikade, Katuwapitiya and Batticola.
E also hit di Shangri La, Cinnamon Grand and Kingsbury hotels all of dem dey for di capital, Colombo.
Wia dis foto come from, Reuters
One of di blasts hit St Anthony church for Kochchikade
Authorities don announce 6pm to 6am curfew for di city of Colombo.
Easter Sunday na one of di major feasts wey dey for Christian calendar.
Sri Lanka media dey also report say foreign tourists fit dey among di casualties, but until now, nobody don come out tok say na dem dey responsible for di attacks.