Covid-19: Coronavirus deaths don pass one million for di world, see wia di outbreak hit di most

Foto of coronavirus and di numbe rof deaths

Wia dis foto come from, Reuters

Coronavirus now don contribute to di deaths of one million pipo worldwide.

Di reports of di millionth death arrive just short of 10 months afta dem confam di first death for China, in January.

Graph wey show wia di million deaths happun

Di virus continue to dey spread across di world, with more dan 33 million confam cases in 188 kontries.

Di virus dey rise for many regions and some kontries wey dey successful in fighting di first outbreaks don again dey record rise in infection rates again.

mapped

Confam cases wey dey for di world

Group 4

Abeg upgrade your browser to see di full interactive

Source: Johns Hopkins University, national public health agencies

Last figure update 5 Julai 2022 08:59 GMT+1