Say no to rape quotes, rape definition, types of rape and wetin dey cause rape and how to stand against rape culture dey inside dis tori
- Damilola Banjo
- Broadcast Journalist, Pidgin Service, Lagos

Wia dis foto come from, Charlie Northcott
Kiki Mordi na activist against sexual abuse for Nigeria
For more than one week, social media don dey fire sake of plenti rape cases wey pipo dey report.
Inside one week alone, seven rape cases don happun. Dis con dey make pipo dey kwesion wetin rape mean sef.
Dem dey even ask if rape get type and wetin dey cause am as e appear say dem dey confused.
BBC Pidgin follow Lagos State Domestic and Sexual Violence Response Team (DSVRT) plus oda sabi pipo tok and dem explain kwesion wey pipo bin dey ask.
Wetin be Rape?
Rape na penetrative sexual intercourse. E no end dia, some tins must dey inside for it to be rape. E must dey forceful and for sex to be forceful. E mean say, consent no dey inside. Di major ingredient for rape na say consent no dey inside di sex. Where consent no dey, rape don shele.
Some pipo fit tink say silent means consent. No be so. Sex suppose be choice from both parties. Force no suppose dey. E no suppose be alcohol induce. Pressure no suppose dey inside.

Wia dis foto come from, @MaroAkpobaasaha
Women for Benin do protest against Rape
If pesin change dia mind for last minute and you no hear, na im be say you don rape her. If she change her mind, na im be say, her consent no longer dey dia. Di consent need dey clear. No assumption. If she no tok, no be consent. If she come your house, no be consent.
If you go do kerewa wit pesin, you pipo need define wetin you wan do. E no suppose be say you go tok say you just wan do small or you go just kiss and u con dey do more dan wetin you tok, consent no go dey dat kind tin. Yes na yes and no na no.
Types of rape Dey?

Wia dis foto come from, @MaroAkpobaasaha
Women for Benin do protest against Rape
Types of rape dey. Wetin law go call am go be different but na di same tin and we sabi say penetration don happun.
E fit be physical penetration wey go mean say pipo dey put finger inside person something. E fit also be penial penetration wey be di normal one wey we sabi as rape.
Sexual assault also dey and e dey punishable. Dat one mean say you dey touch. Dia need be physical contact sexually.
Harassment too dey, everytin dey under one big umbrella wey be sexual violence. Under sexual violence, sexual assault dey inside and inside dat one physical penetration dey dia and rape imsef wey be penial penetration.

Wia dis foto come from, @MaroAkpobaasaha
Women march go Edo state police command to protest against rape for di kontri
Punishment dey for different type and di punishment fit go as high as life imprisonment. E fit be 60 years. One man chop 60 years imprisonment last year.
According to Isaiah Owolabi, di Co-founder & Project Director, HACEY Health Initiative, oda types of rape include:
•Spousal rape
•Intimate partner rape
•Child sexual abuse
•Statutory rape
•Date rape
•Serial rape
•Gang rape
Wetin dey Cause rape

Wia dis foto come from, @MaroAkpobaasaha
Women protest against recent rape mata wey dey happun for di kontrr for Benin state, Nigeria
Rape na some kain abnormal for our society. Our culture for dis part of di world be patriarchal wey give men too much power. Na one of di causes be dat. Anoda cause na say men wey dey rape don suffer abuse wen dem small. Our research wey we do show am. Di kain abuse wey dem don suffer for dia young years con dey show face later. Dis one na di psychological factor. Di erpetuator go wan dey do wetin dem do do to dem before. Pipo fit even say rape na some kain mental disorder but dat one na lie.
Justification no dey for rape. None of dis tins you fit use to justify rape according to law.
Rape statistics for Nigeria
According to Isaiah Owolabi, Co-founder & Project Director of HACEY Health Initiative, public data on di total number of rape cases reported to di police np dey.
He say even if dem dey available, we no fit depend on dos numbers, for plenty reasons, wey include di fear of shame, police extortion, and lack of trust for di criminal justice system.Plenty sexual assault victims no dey make formal reports for police stations.
According to research for trends and patterns of sexual assault for Lagos, Nigeria wey Oliver Ezechi of Clinical Science Division of Nigeria Institute of Medical Research led, offender dey be persin wey - victim know (52.0%) and di assault occurre mostly for di offenders house or office (48.5%). Sexual assault wey occur for vaginal route na only (87.2%) be di common route of sexual assault. Di threat of violence (31.1%) and physical force (29.6%) be common methods for overcoming the victims.
Way we fit stand against rape culture
Rape culture be dey mainly fuel by gender inequality and strong patriarchal beliefs, dominance, control and power. With time, e don become embedded for di way we think, speak and act, hence e dey encourage and excuse rape. E dey important to end rape culture.
How we fit stand against rape culture include:
• Create culture of consent
E dey important to ask for consent every time. Always ensure say di "yes" dey loud.
• Challenge wetin dey cause rape
Rape culture still dey happun sake of say we continue to buy into di idea wey see "dominance", "control" and "violence" as "strong" and "male" and dey encourage society wer women no dey valued.
• Get zero tolerance for sexual violence for places where you live, work, school, worship and play. Make your stance on sexual violence dey known and clear.
• Believe and support survivors of sexual violence.
• Be your broda keeper
Take action wen you notice someone dey take advantage of someone who no dey able to give consent.
• Educate your children, friend, parents, colleagues, peers and strangers on di lie and facts of rape.
• Advocate for di implementation and enforcement of laws and policies on rape
Rape culture persist sake of lack of enforcement of laws wey dey address rape. To end rape culture, offenders must dey accountable for dia actions.
You fit also like to watch dis video
Her family tell BBC say dis incident happun on Tuesday for Ibadan.