Obaseki resign from APC to find ticket anoda place for Edo state governorship race

Godwin Obaseki

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Edo Govnor, Godwin Obaseki

Edo State Govnor, Godwin Obaseki, don formally announce im decision to resign im membership of di ruling All Progressives Congress.

Di governor announce im resignation on Tuesday afta im meet with President Muhammadu Buhari for di Presidential Villa for Abuja, di nation capital.

Na last week, APC declare say Obaseki dey unfit to contest for re-election under di platform. Im disqualification to run make pipo criticise di party say dem dey witchhunt am sake of im gbege with di party National Chairman Adams Oshiomole.

Obaseki bin also visit Govnor Nyesom Wike of PDP for Rivers State Goment House inside Port Harcourt two days afta di disqualification from APC, say make im no contest di 22 June 2020 party primary for di state.

Wike na one of di pipo wey criticise Obaseki disqualification and APC handling of di mata.

Tori bin don dey fly upandan say di govnor dey go PDP to collect ticket to contest for second term in office, but di govnor never tok wetin im next move go be.