South east governors bans open grazing: Umahi explain why dem ban movement of cows by foot

Wia dis foto come from, Ebonyi Online
South east govnors don ban open grazing, di Chairman Southeast Governors' Forum, David Umahi don confam.
Govnor Umahi of Ebonyi says di south east zone ban open grazing of cattle inside dia areas
Na during one APC stakeholder meeting for Christian Ecumenical Centre Abakaliki, di Ebonyi State Govnor announce dis mata.
Di Southeast Governors' Forum also ban di movement of cows by foot into di zone and beg leaders to show loyalty to Nigeria alias patriotism for dia conduct to guarantee di unity of di kontri.
Govnor David Umahi say: "We dey live in a dangerous time, without patriotism to our nation Nigeria, e dey very difficult to get a peaceful time"
Make leaders and stakeholders of di zone to speak up and avoid playing politics with di Security of di zone and nation.
"Govnors of South East don dey call on our leaders to speak out on di Security of di zone and unity of Nigeria, I read on paper where someone say im dey givie Governors of South East 7-days to ban open grazing, di Governors of southeast don ban open grazing and movement of cows by foot into South East, in each of States of di South East, we dey manage ourselves well, wetin we discuss wit di herdsmen na di system wey dey place for a long time."
E also caution pipo of di zone against instigating crises inside Nigeria through sharing of fake videos wey dey claim killing of Fulanis by IPOB for inside di South East.
"Wetin our pipo must know be say security no dey political, wetin dey expected of di leaders na to put up programs wey favor di pipo and encourage national unity"
Gov. Umahi also say im support di call to flush out criminal elements from forests across di nation to boost the security of di kontri.
"Inside our forests today, we get di kidnappers, herdsmen, cultists, all sorts of criminals, anybody wey dey stay inside di forest dey take risk, when we say make pipo move out of di forests, na for dia own safety and security, so I support say make kidnappers, herdsmen, cultists, and bandits should dey flushed out of our forests"
Dis move by di south east Govnors dey come just at di same time wen some states for di southwest region of Nigeria dey face di same challenge of killer herdsmen.

Sunday Igboho latest news today: Yoruba activist address youths say e enta Ogun State to 'chase out killer herdsmen'
Sunday Igboho charge di youths wey gather to meet with am say dem go enta di bush to go meet wit di herders to ask weda na dem get di land or na for di pipo of Ogun State.