Ngozi Okonjo-Iweala WTO DG: Fans use #BeLikeNgoziChallenge to pay tribute to Nigerian World Trade Organisation new Director General

Wia dis foto come from, Getty Images/Temie Giwa-Tubosun
Nigerian supporters of Ngozi Okonjo-Iweala, di first woman and first African to become World Trade Organization (WTO) oga, dey pay tribute to am in one unique way.
Some of dem dey wear cloth to resemble how madam Okonjo-Iweala dey dress.
Di whole tin start after one businesswoman Temie Giwa-Tubosun promise to give 100,000 naira ($262; £189) to di pesin wey dress up to resemble Ngozi Okonjo-Iweala pass.
Giwa-Tubosun tweet one play-play video of herself wia she dress and begin talk like di former finance minister, wey WTO officially announce on Monday 15 January as dia oga.
On why she decide to do dis 'challenge' in honour of di new WTO oga, Giwa Tubosun say: "I love her. Her tori inspire me. She be Nigerian-American like me, both of us be mama, and we resemble small".
Although she hold US citizenship, na for di eastern region of Nigeria dem born Okonjo-Iweala, and she no dey shame to wear her native attire - even for official work.
Many don admire her colourful dressing and unique way she dey tie her head gear.
See entries from social media pipo
Wia dis foto come from, Twitter/@BimYonce
Wia dis foto come from, Twitter/@Jamesorior