Plane crash in Abuja: Military aircraft crash near Nnamdi Azikiwe International Airport - Seven confam dead

Wia dis foto come from, IMOLE AYO/TWITTER
Authorities don confam say seven pipo die afta one Military aircraft King Air 350 crash for Abuja, Nigeria on Sunday.
Di Nigerian Airforce don also release di names of pipo wey die for di crash.
According to reports, di incident happun afta dem report engine failure as e dey try fly back to di Abuja airport afta dem bi commence trip to Minna, Niger state.
Director of Public Relations and Information Headquarters Nigerian Air Force, Vice Marrshal Ibikunle Daramola confam say na Nigerian Air Force (NAF) Beechcraft KingAir B350i aircraft crash while dem bin dey return to di Abuja Airport afta dem report engine failure on dia way to Minna.
Oga Daramola wey say first responders dey di scene of di accident also confam say all di seven pipo onboard die for di crash.
Names of pipo wey die for di crash
a. Flight Lieutenant Haruna Gadzama (Captain)
b. Flight Lieutenant Henry Piyo (Co-Pilot).
c. Flying Officer Micheal Okpara (Airborne Tactical Observation System (ATOS) Specialist).
d. Warrant Officer Bassey Etim (ATOS Specialist).
e. Flight Sergeant Olasunkanmi Olawunmi (ATOS Specialist).
f. Sergeant Ugochukwu Oluka (ATOS Specialist).
g. Aircraftman Adewale Johnson (Onboard Technician) no survive- all seven of dem die.
One Twitter user Imole Ayo bin share videos and fotos of di accident.
Oga Daramola say di Chief of Air Staff don order immediate investigation into di incident.
E also ask di general public to remain calm wait for di outcome of investigation, as dem condole with di families of di pipo wey die.

Plane crash today Abuja: Nigeria Airforce aircraft crash near Nnamdi Azikiwe International Airport afta engine failure report -Eyewitness tok how e happun
Nigeria Aviation Minister Hadi Sirika don confam say one military aircraft, King Air 350 don crash for Abuja.