Champions League: See when and how di UCL quarter-finals draws go happun

Wia dis foto come from, Getty Images
Di draws for di quarter-finals for dis seasons champions league don set. Eight teams go compete for di biggest club trophy for Europe.
Manchester City, Real Madrid, Dortmund, Liverpool, PSG, Porto, Chelsea and defending champions Bayern Munich for di Champions League quarter-finals na di teams wey qualify.
Dis eight teams, each of dem go dey drawn from one pot to decide who go face who and who go dey home first.
When be Champions league quarter final draws?
Di Uefa Champions League quarter-final and semi-final draws go happun on Friday 19 March for dia headquarters for Nyon, Switzerland..
Di semi-final draw go follow di quarter-final draw and again nothing like seeding or country protection.
Dates for Champions league quarterfinal matches
First leg: 6-7 April
Second leg: 13-14 April
Dates for Champions league semi finals
First leg: 27-28 April
Second leg: 4-5 May
Champions league finals date
Saturday 29 May (Atatürk Olympic Stadium, Istanbul)









