John Magufuli dead: Tanzania president death tori make Boris Jonson and Goodluck Jonathan send tributes

"Magufuli death"

Wia dis foto come from, Getty Images

Tributes don begin come in for Tanzania President John Magufuli wey die on Wednesday age 61.

Vice-president Samia Suluhu Hassan tok for her address on state television say im die from heart complications for one hospital for Dar es Salaam.

US State Department don express dia condolences to Tanzanians, dem say "we hope say Tanzania fit move forward on a democratic and prosperous path".

British Prime Minister Boris Johnson say him dey sorry to hear of President Magufuli death.

Skip Twitter post, 1
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post, 1

Former Nigerian president Goodluck Jonathan hail Tanzania President John Magufuli as "partner in democracy" and "patriot wey love im kontri."

Skip Twitter post, 2
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post, 2

Tanzania opposition figure Zitto Kabwe offer im "deepest condolences to Janet Magufuli and di whole family of John Pombe Magufuli, I dey offer my condolences to di deputy chairman of CCM [the ruling party] and CCM members on di loss of dia Chairman".

Skip Twitter post, 3
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post, 3

Di Former Tanzania Prime Minister Fredrick Sumaye say "e shock me and at first I bin tink say no be true. Na very shocking news. To lose a sitting president na big tragedy".

And Venezuela President Nicolas Maduro also send im condolences to di Tanzania pipo on di death of President John Magufuli.

Skip Twitter post, 4
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post, 4

Meanwhile Somalia President Mohamed Farmajo also react to di President death.

Skip Twitter post, 5
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post, 5

"We wish di Tanzanian nation and di goment patience and calm during dis mourning and prayer period," di president post on Twitter:

Authorities for Tanzania don announce 14 days of national mourning to mark di death of President John Magufuli.