New Chief of Army Staff: Buhari appoint Major General Farouk Yahaya to replace late Lieutenant General Ibrahim Attahiru

Wia dis foto come from, Defence HQ
Nigeria President Muhammadu Buhari don appoint Major General Farouk Yahaya as di new Chief of Army Staff.
According to statement from di Acting Director Defence Information, Brigadier General Onyema Nwachukwu,
Major General Yahaya before im appointment be di General Officer Commanding 1 Division of di Nigerian Army and di present Theatre Commander of di Counter Terrorism Counter Insurgency military outfit for di North East, with code name Operation HADIN KAI.
Major General Yahaya appointment dey come about a week afta di former Chief of Army Staff Lieutenant General Ibrahim Attahiru and 10 odas die for military plane crash for Kaduna. Dem bin dey on official from Abuja to Kaduna.
Di Air Force bin tok for statement say di plane crash near di Kaduna airport and dem dey investigate di the immediate cause of di crash.
'Third Army Chief'
Major General Farouk Yahaya go be di third Chief of Army wey Buhari dey appoint since e come into office as democratic president for 2015.
For July 2015, wen im win election and become president, Buhari appoint Major-General Tukur Buratai as di Chief of Army Staff.
Im biggest task na to dismantle and clear out di Boko Haram insurgents from di sambisa forest and di north east.
During im swearing in ceremony, President Buhari bin give order to military to move dia command centre to Maiduguri, the Borno state capital to fight Boko Haram.
For 26, January 2021, afta plenti criticism and calls for sack of di service chiefs sake of di unending issues of insecurity for di north and Boko Haram palava, di presidency announce say President Muhammadu Buhari accept di immediate resignation of di old Service Chiefs and approve dia retirement from service.
Dat announcement come with di appointment of new Service Chiefs; Lieutenant General Ibrahim Attahiru take over from Major-General Tukur Buratai.
Lt Gen, Attahiru die wen di military plane e dey crash for Kaduna on 21, May, 2021.
Dat na just barely four months wen e assume office.
Major-General Yahaya appointment announcement come about a week afta im death










