Big Brother Naija housemates eviction: Michael, Kayvee, JMK, Queen get in as Yerins, Niyi, Beatrice chop eviction

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
BBNaija Shine Ya Eyes evict Yerins, Niyi and bring in new housemates
Yerins na first to chop eviction for Big Brother Naija reality show on Sunday.
Also, Niyi chop eviction from di TV reality show on 8 August, 2021.
E no end dia, Beatrice also suffer eviction from season 6.
But first Michael na di new housemate wey go join di BBNaija Shine Ya Eyes house.
No be only Michael, Biggie reveal more new housemates inside wetin be like new twist.
Kayvee, Jumoke [JMK] and Queen na some of di newest housemates.
Wia dis foto come from, BBNaija
Michael - BBNaija new housemate
Preacher of love, but entertainer of drama Michael Chukwuebuka Ngene no like pretentious pipo.
And e insist say you no go catch am fighting over girls, food, and chores inside di Big Brother Naija House.
Michael bin relocate wit im family to United States for a while before e return to Abuja wia im mama dey live now.
Kayvee - BBNaija new housemate
A self-confessed bad boy, 26-year-old photographer Kayvee say im different background go help am keep im head in di game.
He dey ready to spice things up inside di House with im positive energy and im dance moves.
grow up for Nigeria
Wia dis foto come from, BBNaija
Di four new new housemates wey enta Biggie 'Shine Ya Eyes' TV reality show on Sunday.
Jumoke JMK - BBNaija new housemate
23-year-old law graduate JMK [Jumoke Adedoyin] dey ready to spice things up in the House by being di life of the party.
She grow up for Ilorin Kwara State say pipo go love her because she bring positive energy and mak pipo happy.
Her strategy for this season? She say, No strategy!
Wia dis foto come from, BBNaija
Queen - BBNaija new housemate
Queen-Mercy Okon Atang from Akwa Ibom State like to show off her "sweet" body and feel say clothes dey overrated.
Dis happy girl and beauty queen, wey say she be politician and entrepreneur, plan to be nice to everyone inside Big Brother Naija House.
But she say she no go waste time to "bite" wen someone step on her toes.
She be 26-years-old graduate of Nnamdi Azikiwe University wey dey live for Lagos.
Wia dis foto come from, BBNaija
Yerins, Beatrice, Whitemoney, Yousef and Niyi na im bin dey all dey up for possible eviction on Sunday.
Di evicted housemate
Wia dis foto come from, Bigbronaija
Yerins
Im be medical doctor wey say "e like to eat even though e no dey show for im body".
E describe imsef as 'polymath' wey get undying love for many creative things.
Wia dis foto come from, Bigbronaija
Niyi
Dis former basketballer come from Oyo State and e don marry wit one pikin.
Im also be businessman wey dey run fantasy game platform and event business for Cape Town, South Africa.
Niyi dey 6'6'' in heigth and likely go be di tallest housemate on dis season edition of di show.
Wia dis foto come from, BBNaija
Beatrice
Beatrice na fashion model wey come Port Harcourt, Rivers State.
She also get clothing brand and afta di show she dey plan to improve on am and build a modelling agency
She love to dance and she say she dey come di house wit lots of entertainment.
Beatrice dey single.