Big Brother Naija 2021 housemates eviction nomination: Arin, Emmanuel, Nini, Princess, Saskay, Tega dey up for eviction

Big Brother Naija 2021 housemates nomination for eviction: BBNaija Arin, Emmanuel, NiNIN, Princess, Sakay, Tega dey up for eviction

Wia dis foto come from, BBNaija

Six BBNaija housemates from di 'Shine Ya Eye' Big Brother Naija reality TV show don dey up for possible eviction dis Sunday.

Di housemate wey dey qualify to nominate pipo bin nominate Arin, Emmanuel, Nini, Princess, Saga, Tega to leave di house.

But di new Head of House, Pere save Saga and replace am with Saskay.

Dis one mean say now Saskay go join pipo wey dey up for possible eviction on Sunday.

Nomination for di Sunday eviction take place on Monday evening afta di Head of House challenge wey Pere win.

Di head of house plus di new housemates wey be; Michael, Kayvee, Jumoke and Queen dey immune from di nomination.

BBNaija eviction latest housemates nomination breakdown

Big Brother call di housemates one by one inside di diary room for dem to call di two names of pesin wey dem want to see say dey up for eviction.

Wia dis foto come from, BBNaija

Boma: Boma nominate Saskay and Princess

Cross: Cross nominate Princess and Tega

Saga: Saga nominate Princess and Tega

Saskay: Saskay nominate Whitemoney and Nini

WhiteMoney: WhiteMone nominate Arin and Jaypaul

Nini: Nini nominate Princess and Emmanuel

Jacky B: Jacky B nominate Saga and Nini

Sammie: Sammie nominate Tega and Princess

JayPaul: JayPaul nominate Maria and Peace

Liquorose: Liquorose nominate Saga and Arin

Arin: Arin nominate Emmanuel and Tega

Yousef: Yousef nominate Boma and Arin

Princess: Princess nominate Saga and Arin

Peace: Peace nominate Tega and Princess

Emmanuel: Emmanuel nominate Arin and Angel

Tega: Tega nominate Nini and Arin

Angel: Angel nominate Princess and Emmanuel

Maria: Maria nominate Arin and Angel

Pere: Pere nominate Princess and Saskay

Wia dis foto come from, BBNaija

Wetin we call dis foto,

Pere and Boma

Before today nomination, former housemate like Beatrice, Yerins and Niyi bin leave di house last Sunday as dem get di lowest votes out of those wey bin dey up for eviction.

Meanwhile, Afta Pere win di HOH challenge today, e chose Maria im deputy Head of House.