Chidinma Ojwuku: Court remand Chidinma for Michael Usifo Ataga murder case

Wia dis foto come from, OTHER
Michael Usifo Ataga
Chidinnma Ojukwu bin no fit plead or speak during her alleged murder trial first court hearing.
Yaba Magistrate High Court in Lagos bin sit for di first time to table di suspected murder of Michael Usifo Ataga wey be Lagos billionaire.
But Monday hearing na to remand di prime suspect and her co-defendant Quadri Adedapo, for thirty days in di first instance.
Chidinma Ojwuku lawyer no oppose di remand on top say e bin dey expect am.
Di goment lawyer alias prosecution say di reason for di remand na so dem go fit assign di case.
Police bin discover di Super TV CEO dead body inside one short let apartment for June 2021 for Lekki Lagos.
Days later, police arrest 21-year-old Chidinma wey be university student after dem begin search for one female suspect for di mata.
Di judge bin adjourn di Michael Usifo Ataga matter till September 5, 2021
Until then, Chidinma go dey prison yard for alleged murder accuse.
Chidimma Adaora Ojukwu: Wetin we know about her profile
Chidimma Adaora Ojukwu na 300 level student of University of Lagos Unilag.
She dey study mass communication for University of Lagos, according to di police.
She dey live wit her parents for Alagomeji area for Yaba Lagos.
Na for dis her parents house police say dem arrest her.
Chidimma be native of Abia state for south east Nigeria, according to wetin she tell tori pipo on Thursday.
University of Lagos tok-tok pesin Nonye Oguama don confirm to BBC Pidgin say di alleged murder suspect na dia student.
Until dis alleged murder investigation, Chidimma Ojukwu bin dey run part time studies for Unilag, Mrs Oguama tok.
Lagos police command say dem arrest Chidimma for her parents house on Wednesday night.
Usifo Ataga, Lagos billionaire 'suspected' murder - How e happun
Police don confirm how di 'suspected' murder of Lagos billionaire Michael Usifo Ataga happun for Nigeria commercial capital.
Na one lady [Chidimma Adaora Ojukwu] wey dey on di run dat time na im police say kill di Super TV CEO afta dem find Ataga lifeless bodi on Thursday 18 June, 2021 .
Lagos Police Commissioner Hakeem Odumosu tell BBC Pidgin say di crime happun inside a three bedroom flat for Lekki Phase 1.
"Di man [Michael Usifo Ataga happun] join her dia on Sunday. Then on Thursday di man suppose go to Abuja to meet im wife for dem to celebrate im 50th birthday.
"Unfortunately dat day e no come out. "Im apparently lock di door and wen dem force di door open, dem unfortunately see im lifeless bodi on di floor."
"E [Michael Usifo Ataga happun] bin dey wit only boxers inside a pool of blood," according to di Lagos police boss.
Di police oga add say dem find out say di lady [referring 'Chidimma Adaora Ojukwu'] wey bin dey with am claim to be one Americana wen she meet di billionaire.
E later turn out say she use phone app take generate international number wey she use make di call to book di room.
Reports say Ataga wey dey live inside Banana Island, na concerned friends and family report say im go missing on Sunday 13 June.
Dis na after all efforts to reach him no succeed, e come put everyone in a panic mode including his wife and family in Abuja.
Police tell BBC Pidgin say di lady take im phone and ATM card wit her.
"Na block of flats wey somebodi rent, but di pesin no dey live dia, so di pesin convert di place to a short let."
"May be na di man rent am ask di lady to move in dia or di lady book and di man join, but both of dem bin dey dia on Sunday," CP Odumosu add.
"Dem stay dia for three to four straight days, moving out together wit di man car. Di three bedroom flat na service apartment"
Local media dey report say Nigeria secret police [DSS operatives] all di way from Abuja, through di efforts of di wife, track down di owner of di Airbnb domot.
Na di owner of di apartment wey receive payment from di lady bank account into which Ataga bin previously make a transfer for di payment to, di media report add.
On di whereabouts of di suspected murderer, di police chief say:
"She bin make withdrawals of undisclosed amount of money from di ATM card she allegedly take from Ataga, afta im death, and when we get to know we block am."
CP Hakeem Odumosu also tell BBC Pidgin say dem don inform di Super TV Nigeria CEO family and all concerned about di suspected murder.
"We dey track di phone, because di place [wia di crime happun] no dey traditionally or legally registered to provide dat kain service. Odumosu tell BBC on Sunday 20 June.
"If to say na hotel, at least di information wey dem for don enter for help, may be CCTV for help but in dis case di place na just a block of flats wey be residential."
Di pesin wey rent di apartment to di lady on di run dey police custody and dey help wit information wey fit lead to her arrest.
Di Range Rover car, wey Michael Usifo Ataga cari go di place wia im suspected murder happun, dey police hand, CP Odumosu add.