Dauda Sheidu: Di Kogi vulcanizer wey im amputee condition no stop am to fix tires no mata di size
Produced by: Chukwuemeka Anyikwa
Dauda Sheidu na one pesin wey im story dey inspire plenty pipo for im community.
Dis man na 35-year-old vulcanizer for Okene, Kogi state north-central Nigeria.
Oga Sheidu lose him right hand on top accident for 2001 wen im dey do ọkada work.
E happun after he no fit raise money to take open shop for Vulcanizer work wen e don learn.
Pipo wey he dey work for dey happy for am sake of im skill, dedication to work and good relationship wit im customers.
But wen he first start, pipo bin dey luk down on am, dey tink say he no go fit do di work well.
Wen BBC Pidgin ask am how e dey feel for di one hand wey he no get, he talk say;
Im no dey regret im life because him feel say anything wey he suppose get wit two hands, he still get am wit one hand.
He say im friends begin avoid am wen he first get accident.
Sotey even im first wife bin leave am because she bin dey fear how im husband go fit feed and take care of im family.
But, since im current condition happun, Oga Sheidu don get three shops and come get boys wey dey work for am.
Even some of dem don do freedom go open dia own shops for Abuja.
Aside im vulcanizer work, Dauda Sheidu get farm wey he dey go every Sunday wit im wives and children.
He talk say na from dis deem dry get some of di food wey dem dey chop.