Rachel Oniga burial: Nollywood actress Rachael Oniga funeral photos

Rachel Oniga Burial

Wia dis foto come from, BBC/odas

Wetin we call dis foto,

Rachael Oniga die on Friday 30th of July for di age of 64 from heart related issues.

Nollywood actress, Rachael Oniga begin her final journey out of mother-earth on Friday.

Families, friends and colleague of di late actress gada for Magodo, Lagos Nigeria for her burial ceremony.

Di burial arrangement for di veteran Nollywood veteran bin start on Monday with symposium.

Na coalition of non-governmental organisations and friends of di actress organised am.

On Thursday August 26, dem do service of songs for di Catholic Church of Resurrection, Magodo phase 2 Lagos.

Friday lying-in-state for di same venue, go follow di requiem mass and di burial later.

Dis be according to one statement wey di family bring out.

Na immediate family members go attend di interment, according to di statement.

While di reception of guests hold for di Grandeur events centre inside Oregun, Ikeja inside Nigeria commercial capital.

Photos from Rachael Oniga Burial

Tears and emotions boku during Rachel Oniga burial.

Here na oda photos of how di events waka;

Rachael Oniga die on Friday 30th of July for di age of 64 from heart related issues;

Dat na one sickness wey she battle with for a short period before she die.

Rachel Oniga profile

Rachel Oniga na one of di ogbonge actress wey follow raise di profile of Nollywood feems from di late 90s.

Oniga don act inside more than 100 feems both in her kontri and internationally.

Her feem credits include di 2018 hit feem 'Chief Daddy' wey Akindele-Bello and Kate Henshaw-Nuttal follow act inside.

Wia dis foto come from, Instagram/Rachel Oniga

Dem born Rachel Tabuno Oniga on 23 May 1957 for Lagos although she bin hail from Delta State, Nigeria.

She begin her acting career for 1993, and small time afta feature inside 'Sango' wey bi feem about di Yoruba deity god of lightning.

But many Nigerians go sabi am for her role inside long-term television show 'Super Story'.