Akuapem Poloo granted bail: Ghana Court reverse Rosemond Alade Brown 90-day prison sentence

Akuapem Poloo: Ghana Court reverse Rosemond Alade Brown 90-day jail, slap am plus Ghc12,000 fine fine

Wia dis foto come from, Instagram/Akuapem Poloo

Wetin we call dis foto,

Akuapem Poloo

Appeals Court for Ghana impose Ghc12,000 fine on actress Akuapem Poloo and reverse her 90-day jail on Wednesday.

Dis be after her lawyers appeal her case, dem pray de court to grant her non-custodial sentence for her offense.

Based on de court ruling, de actress go wey real name be Rosemond Alade Brown fit go home to her family after she satisfy de fine conditions.

How Akuapem Poloo return to jail

Akuapem Poloo go back to jail to continue en 90 day jail sentence on December 1, 2021.

Dis be after High Court for Accra dismiss en appeal for non-custodial sentence.

Around July last year, Akuapem Poloo enter wrong side of de law after she post nude photo of herself and son online as part of en seventh birthday.

Because of dis Accra Circuit Court sentence her to three months in prison for April 2021 but after her lawyer file for appeal court grant am bail.

However de High court reverse de bail decision, presiding judge Justice Ruby Aryeetey talk say de sentence dem give am no be excessive, sake of dat dem no go interfere plus am.

"De court only go interfere if de sentence be excessive" she add.

Wia dis foto come from, akuapem_poloo/Instagram

How Akuapem Poloo first land jail sentence

Accra Circuit Court for April dis year sentence Ghanaian actress, Rosemond Brown to three months in prison.

De Court argue say de reason for de punitive sentence be sake of dem wan use dis case serve as deterrent to de general public.

De court also reveal say de pregnancy test of de accused be negative.

De reason for en sentence be sake of around July last year, she post nude photo of herself den son online as part of en seventh birthday.

She plead guilty to three charges wey de court level against am which dey include - de publication of obscene materials, engaging in domestic violence in ways which dey undermine de privacy and integrity of another person.

De other charge finally be engaging in domestic violence which go fit spoil de dignity of another human being.

Who be Akuapem Poloo

Wia dis foto come from, Social

Wetin we call dis foto,

Akuapem Poloo

Akuapem Poloo wey her real name be Rosemond Alade Brown na Ghana Actress, video vixen and get huge presence for social media.

De Ghanaian actress rise to limelight through social media where she dey entertain people.

Dem born am on 1st June, 1989 for Suhum, Eastern Region of Ghana.

She attend Suhum Roman Catholic School wey she continue to Ofori Panyin School. She later continue to Adonten Senior High school.

Later she move to Accra to pursue en acting dreams, but she find fame for social media after en twerking videos start dey go viral.

Akuapem Poloo wey be singer mother born her first son at age 24, but she no dey plus de man.

Out of de fame, she start dey act movies until she recently branch into business.

Akuapem Poloo dey call hersef Ghana Cardi B base of di strong love likeness wey she get for de American singer.

Cardi B describe am as en twin sister for Ghana after Poloo impress am during en visit to Ghana.

And for some occasion, Cardi B don chook mouth for mata wen concern Akuapem Poloo.

De American singer bin tok one time say di prison sentence dey too harsh as punishment for Akuapem Poloo.