Boris Johnson visits Ukraine: UK Prime Minister meet Zelensky for Kyiv over Russia war
Watch: Boris Johnson and Volodymyr Zelensky tour Kyiv near-empty streets
UK wan send 120 armoured vehicles and anti-ship missile systems to support Ukraine for dia wahala with Russia.
UK Prime Minister Boris Johnson announce dis wen e do tok-tok for Kyiv with Ukraine President Volodymyr Zelensky, Downing Street tok.
Di Prime Minister office say di visit na "show of solidarity" with Ukraine.
One tok-tok pesin say oga Johnson dey use di trip to set out new package of financial and military aid.
Dis dey come di day afta oga Johnson announce £100m of weapons for Ukraine afta di bombing of refugees for one railway station.

Wia dis foto come from, Russia Ukraine: Boris Johnson don travel to Ukrain
Boris Johnson and Volodomyr Zelensky
"Di prime minister don travel to Ukraine to meet President Zelensky in pesin, in show of solidarity with di Ukrainian pipo," Di tok-tok pesin add.
"Dem go discuss di UK long-term support to Ukraine and di PM go set out new package of financial and military aid."
Ukrainian embassy for London post one foto of di meeting online.
Di Ukrainian embassy for London tweet picture of di two leaders meeting face to face.
For one Facebook post, Andriy Sybiha, deputy head of di Ukrainian president office say: "Di UK na di leader in defence support for Ukraine."
"Di leader for di anti-war coalition. di leader in sanctions against di Russian aggressor."
Boris Johnson visit Ukraine fotos

Wia dis foto come from, Photoshot

Wia dis foto come from, Reuters
Boris Johnson waka around central Kyiv with President Volodymyr Zelensky

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Russia Ukraine: Boris Johnson don travel to Ukrain
Boris Johnson and Volodomyr Zelensky