When Emirates go resume flights to Nigeria? Emirates Airlines latest travel update on flights to/from Nigeria to Dubai

"When Emirates will resume flights to Nigeria?"

Wia dis foto come from, Getty Images

Emirates airline don announce new updates on when dem plan to flights to/from Nigeria to Dubai.

In line with goment directives, passenger services from Nigeria (Lagos and Abuja) to Dubai dey temporarily suspended until 20 March 2021. Di airline announce dis week.

Customers from both Abuja and Lagos no go dey ccepted for travel before or on dis date.

Passengers wey don travel to or dey connected through Nigeria in di last 14 days no dey allowed entry into di UAE (weda dem go end dia flight for or dey connect through Dubai).

Wia dis foto come from, NCAA

Emirates flights from Dubai to Lagos and Abuja go continue to operate based on di normal schedule wey passengers sabi. Di airline add.

Dem say dem regret di inconvenience wey dis latest update cause, and make di affected customers contact dia booking agent or Emirates call centre for rebooking.

Emirates say dem remain committed to Nigeria, and look forward to resuming passenger services to Dubai for our customers wen conditions allow.

Since 4 February, 2021 Emirates Airlines stop to dey airlift Nigerians to Dubai from Abuja and Lagos airports sake of di refusal by di Presidential Taskforce on Covid-19 [PTF] to allow di airline conduct rapid test fro coronavirus, wey di airline make compulsory for dia passengers four hours before dem board dia flights.

Presidential Task Force on COVID-19 [PTF], according tori wey dey ground, dey plan to provide di infrastructure for Emirates Airlines to conduct Rapid Antigens Test [RDT] on passengers wey wan flyout from Nigeria in readiness for di resumption of flights by di Dubai-based airline from March 10, 2021.

But wit dis latest travel update, na until 20 March, 2021 na im Emirates Airlines flights to/from Nigeria to Dubai go likely resume.